You are here: HomeAfricaBBC2024 05 17Article 1931311

BBC Pidgin of Friday, 17 May 2024

Source: BBC

Dem find dis Algerian man alive for underground of im neighbour house 26 years afta e miss as young boy

Omar bin Omran family bin tink say e don die during di Algerian civil war Omar bin Omran family bin tink say e don die during di Algerian civil war

Authorities don find one man wey miss about 26 years ago. Dem find am alive for im neighbour basement.

Omar bin Omran bin disappear from Djelfa for Algeria, during di Algerian civil war wey happun for di 1990s, wen e be be teenager.

Dem discover Bin Omran wey be 45-years-old now just 200m from wia e bin grow up.

Officials confam say dem don arrest one 61-year-old man wey dem suspect say hold am as prisoner.

How Bin Omran take disappear

Oga Bin Omran disappearance happun for di middle of one serious gbege wey don dey ground for many years between Algeria government and Islamist groups.

Im family fear say e bin dey among di estimated 200,000 wey kpai, or as many as 20,000 dem kidnap during di kasala.

But finally, dem see am for wia dem hide am, for one sheepfold under haystacks on 12 May, according to reports.

Di public prosecutor office bin receive one complaint against one anonymous pesin wey claim say Mr Bin Omran dey for di house of one of im neighbours, inside one sheepfold, one court official tok.

Di court official tok say: "Following dis report, di general prosecutor order di national gendarmerie to open in-depth investigation and officers go im house to question am.

"On 12 May at 8pm local time, [dem] find di victim, Omar bin Omran, aged 45, for di basement of im neighbour, BA house aged 61."

According to reports, di suspect bin try to run comot di scene, but dem stop and arrest am, di court official tok.

Di ministry tok say investigation dey go on and Oga Bin Omran dey di process of receiving medical and psychological care.

One tok-tok pesin describe di crime as "heinous".

Oga Bin Omran tell pipo wey rescue am say sometimes e dey see im family from di prison di suspect keep am, but claim say im no fit call dem for help “because of one spell wey im captor bin cast on am”, local media report.

Im mama die for 2013.