You are here: HomeAfricaBBC2024 05 15Article 1931119

BBC Pidgin of Wednesday, 15 May 2024

Source: BBC

Wetin pathologist tell coroner about di autopsy result on Mohbad death

Mohbad na one of Nigeria rising musicians, wey die on 12th of September, 2023. Mohbad na one of Nigeria rising musicians, wey die on 12th of September, 2023.

More informate don come out unto di matta wey concern di death of Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey pipo sabi as Mohbad.

Di latest na say pathologist wey appear bifor di coroner on Wednesday reveal di autopsy result bifor di court.

Mohbad na one of Nigeria rising musicians, wey die on 12th of September, 2023.

Di singer bin marry Nigerian woman simply identified as Wunmi and dem get one son togeda named Liam, controversy still dey on di legitimacy of im pikin as Mohbad papa, Joseph Aloba don file court notice to Wunmi make she go do DNA test.

According to, Wahab Shittu, di legal representative for Mohbad family tok say di medical expert say e no fit find out wetin kill di entertainer for dia investigations.

Di lawyer tok say e give reason say by di time dem conduct di test di body don “rotten” and e no dey possible for am to determine di cause of death.

Pathologist tok say e no suppose pass 12 hours afta di death of di pesin bifor dem go conduct autopsy to determine wetin cause di death.

"Wetin e tok be say dem no fit sabi di cause of death and wen you tok say cause of death no dey ascetain e no dey clear," di lawyer tok.

"Pathologist say e no fit attribute am to reactions from certain drugs wey dem administer give di deceased bifor im die but e no fit tok weda na dis drugs cause di death."

Di lawyer explain say e neva see di full report of di autopsy result and di inquiry still dey go on..

Oga Shittu tok say dem neva kwesion di expert but dem go still look into di result to begin kwesion am while e urge pipo make dem remain calm.

Di court adjourn di case to 25 June.

Anoda serious gbege wey dey for court na di testimony of Owodunni Oluwatosin, wey pipo sabi as PrimeBoy.

Primeboy tell di court say Wunmi and Mohbad bin fight for inside im car bifor im die.

E explain give court say Mohbad accuse Wunmi say im no trust if di pikin she born na im own becos dem only knack once bifor she get belle for am.

Prime boy bin tell di court say Wunmi vex for Mohbad for inside di car.

Wetin don happun so far?

For April, Joseph Aloba file serve notice give Wumi through Ikorodu court make dem conduct ova di legtimise of Liam.

Meanwhile, di coroner inquest ova di death of Mohbad still dey ongoing for anoda court.

Di Nigeria Police Force bin assure family, friends and fans of di late Nigerian singer Mohbad say dem go investigate di circumstances wey surround di death of di 27-year-old artiste.

Di management of Mohbad confam di death of di singer afta tori of im passing begin spread.

Di wife bin reveal reason why her husband no ever go hospital wen im get injury for hand.

Dis na sake of how many pipo dey question why she no quickly carry am go hospital.

Wunmi Aloba appear for court for di coroner inquest sitting wey dey look into di cause of death of her husband.

She tell di inquest say e get reason why her husband hate to dey go hospital afta im don face many threat issues from im former label.

Wunmi tok say di whole fear begin from wen Mohbad make attempt to comot di record label and di time wen officers of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) bin carry am and oda record signees.

Na different witnesses don dey testify for court since di siting bin begin and e neva end.

Na Spending bin appear as witness last wia im tok how di fight of Mohbad and Primeboy bin happun bifor di death.