You are here: HomeAfricaBBC2024 05 20Article 1931683

BBC Pidgin of Monday, 20 May 2024

Source: BBC

'AMVCA na my own Met Gala' - Ghana fashionista address Nigerian designer

Popular Ghanaian fashion icon Nana Akua Addo wey pipo sabi as di 'Red Carpet Goddess' Popular Ghanaian fashion icon Nana Akua Addo wey pipo sabi as di 'Red Carpet Goddess'

Popular Ghanaian fashion icon Nana Akua Addo wey pipo sabi as di 'Red Carpet Goddess' don react to di tori about di cloth wey she wear go di 10th Africa Magic Viewers Choice Awards (AMVCA).

Tori bin go viral on social media say Ms Addo, wey don win 'Best Dressed Female' award for previous AMVCAs and wey be one of di celebrities wey her cloth to dis year event totori pipo, no tag di Nigerian designer wey follow design her outfit on her social media accounts.

According to di tori, di Nigerian stylist Ezinne Olivia tok say Addo no give her credit for her work despite her contribution to di di cloth.

However Ms Addo for dis exclusive interview wit BBC Pidgin explain say she bin tag di Nigerian designer Ezinne Olivia, alongside oda pipo wey bin work to create her look for di event, but Olivia say "comot my name, no tag me wit Ghanaian designers."

She add say although she ask Olivia to choose if she want money or make she tag her, Olivia say she prefer money and even wit dat, she still tag her but na she say she no want di tag and she comot her name.

AMVCA na di biggest award event for Africa wey dey usually hold for Lagos, Nigeria commercial capital.

Dis no be di first time wey di Ghana fashion star go show for AMVCA.

For her, na yearly practice wey she no dey like carry over and dat na why according to her she dey like prepare months ahead for di event so dat evri tin, especially her looks go dey perfect. She say for her e be like "project production".

And in all these years, Nana no ever get any known kwanta wit any of her stylists wey go attract media attention.

Instead na hailing pipo dey hail her for how she take dey nail her looks year afta year.

Dis year own no different as she dey recognised as one of di best dressed celebrity for dis year event. She nail di look for di red carpet wit her gorgeous outfit.

But dis year come cause controversy wey make ogbonge designers like Veekee James, Toyin Lawani plus oda celebrities chook mouth for di mata.

"No be all red carpet events I dey attend but if I show, pipo go no know say pesin show." Addo tok.

She say in a year, if na three events she go plan to attend, she go take her time to plan well for di event.

Nana add say for dis particular AMVCA, she don dey plan am ova a year ago, the first outfit she first get, she no like am, so the money she spend waste, but dis oda one she like am well-well and e cost her $6,000.

'I dey see AMVCA as Met Gala' Nana Akua Addo

On why she dey go di extra mile to nail her outfit evri time on di red carpet, Nana tok say she no dey do am to collect any crown but she dey see AMVCA as Met Gala.

So anytime she plan to attend AMVCA, she dey see am as top fashion engagement as Nigeria na African entertainment hub and na platform wia she fit take showcase African beauty, culture and heritage.

Who be Nana Akua Addo?

She be German-born Ghanaian model, actress and film producer.

She study acting for New York Film Academy, USA.

She don feature for some movies wey include; Destiny Child, Speechless, Wanna Be, among odas.

She be di second-runner up for Miss Malaika 2003 and di winner of Miss Ghana- Germany for 2005.

Ms Addo don win many awards as Best Dressed Female celebrity for di many red carpet wey she don grace, wey include 2020 AMVCA Best Dressed, Glitz Style award best dressed, best new actress for 2014, among odas.

Apart from her glamourous social life, Ms Addo na homely pesin.

She be pesin wey get deep values and respect for family and wey sabi balance her career and family.

She tell BBC say family dey important to her so she no dey do too much on social media.

"As I finish AMVCA so, If I reach house, I go comot gloves, comot wig, comot clothes and straight to di kitchen, straight to be a mother, to be a wife and dat na why I no dey do too show for evri event. In a year if na three red carpets I go fit do, e dey okay as balance dey important."