You are here: HomeAfricaBBC2024 05 20Article 1931702

BBC Pidgin of Monday, 20 May 2024

Source: BBC

Di controversy of di divorce of Ghanaian actress Fella Makafui and Medikal

Di two public figures get one daughter Di two public figures get one daughter

One actress and influencer for Ghana, Fella Makafui and im husband wey be musician dey undergo divorce process.

Medikal and Fella wey marry in 2020 don gree say dem go go dia separate ways.

But dis dey cause wahala for social media.

Di two wey pipo sabi as celebrity couple don enta pipo dia eyes well well wit dia collaboration for di entertainment industry during dia 4-year marriage.

Dem release songs togeda wey dem also perform for plenti events.

But dat relationship dey on rocks, di two personalities now decide say divorce na best option for dem and dia daughter.

Wetin happun

Medikal wey organize concert for di O2 indigo for UK early dis month, announce for social media at dat time say im den Fella Makafui no be husband and wife anymore.

But pipo tink say na social media stunt to promote im concert.

Na so Fella Makafui also produce one movie wey premiere am on 11 May for cinemas for Accra.

During im media tour to promote di movie, pipo ask am if im husband go support am dat day, but im no comment.

Inside one petition to di police CID, di actress tok say make police investigate am sake of “im publish false news about am for social media”.

“Medikal don tok false news say im life dey inside danger for di house na so pipo for blame me if sometin happun to am,” Fella tok for di petition.

Im add say di publication of dat tori for social media don dey put im life in danger wey “im plenti fans fit to attack me.”

In one video for Snapchat, Medikal don tok say police come im house afta im wife report am to dem.

Im go on to tok plenti tins wey im do for im wife for dia 4-year marriage wey she no appreciate.

Medikal tok say despite everitin, im wan continue wit di marriage sake of dia daughter but Fella Makafui no dey gree.

“I don invest plenti moni for im businesses, I take care of am well well, im tok say im wan do BBL, I give am moni wey im go do di procedure for Nigeria and Turkey.”

Medikal add say di some of di wahala for dia marriage na sake of one of im wife im relatives come stay for dia house for two years.

Di musician tok many oda tins wey im do give im wife to show say im dey love am bifor tins scatter.

Fella Makafui respond to di claims

Fella Makafui inside one statement tok say im den im husband don gree “few months ago say we go divorce, we don dey wait our families to finish di customary divorce rites.”

Im add say as dem dey wait, im husband dey on top social media dey tok plenty tins about dia marraige, dia daughter and im businesses.

“Dis public statements my husband dey tok, plenti of which no be true, don dey hurt my family and my businesses.”

“For my deep respect for our two families, di privacy of marriage and our daughter, I don decide say I go use only lawful means to address my grievances,” Fella explain.

Im tok say im don “reluctantly begin legal process wey go ensure say me and my daughter don dey safe so say our co-parenting duties go dey properly streamlined according to di law.”

Medikal tok say im no regret say im marry Fella Makafui, na “lesson I don learn”.

Fans of di two personalities don dey tok say make dem no “wash dia family mata for social media.”

Fella Makafui and rapper Medikal marry on 7 March 2020 wit plenti celebrities in attendance.

Dia wedding na one of di most-talked about in recent history for Ghana sake of Fella Makafui collapse during di reception.

One year afta dia marriage, Fella Makafui tok say na fake collapse she collapse.

Plenti pipo sabi at di time say im collapse sake of na she dey pregnant.

But Fella Makafui tok say na stunt she pull for im wedding day.

“I don stage dat collapse for my wedding to test di care and love of my husband.”

Im add at di time say “I be actress, wey I dey prank am many times so I plan say I go do am on our wedding day to see if im go shake.”

Fella Makafui be actress wey become popular afta im star inside TV series, YOLO.

Since den, im don act in many movies wey im get businesses.

Fella also be influencer for brands wey im get ova 4 million followers on Instagram.

Medikal also be musician wey don blow well well for Ghana in 2017.

Dat year, im get plenti nominations alongside Sarkodie at di Ghana music awards.

Im don collaborate wit plenti artists wey im dey among di top five rappers for di kontri.

Im recently play one “sold-out” concert for di O2 indigo wey many big big Ghana artistes fly to support am, including Sarkodie, Efya, Shatta Wale, Bisa Kdei and odas.