You are here: HomeAfrica2024 07 22Article 1941844

Africa News of Monday, 22 July 2024

Source: bbc.com

Wetin dey cause wahala between Dangote and Nigeria goment?

Aliko Dangote as e carry some Nigerian lawmakers go round im refinery facility on Sunday Aliko Dangote as e carry some Nigerian lawmakers go round im refinery facility on Sunday

Tins wey don dey happun recently dey point to di fact say all no dey well between Africa richest man, Aliko Dangote and some agencies of di Nigeria goment.

Many Nigerians bin get hope say wen Dangote refinery start work well well, e go fit make di price of petroleum products come down well well for di kontri, but so far e neva happun like dat.

Nigeria, even though na one of di biggest producers of crude oil for Africa, still dey depend on importation for evri petroleum product like Premium Motor Spirit (PMS) wey pipo know as fuel, kerosene, diesel, and aviation fuel for airplanes.

Di Nigeria goment get four refineries - two for Port Harcourt, and one each for Kaduna and Warri - but dem no dey work, so pipo bin think say dis Dangote refinery go save di situation.

Di initial plan be say di Nigeria goment through di Nigeria National Petroleum Corporation (NNPC) suppose get 20% stake for di refinery.

However, Dangote tell tori pipo for one press conference on July 14 say “NNPC no longer get 20% stake for di Dangote refinery... dem only get a 7.2%".

E explain say NNPC no gree pay di balance of dia share wey dem bin suppose pay by June dis year, and even afta one month grace, dem still no pay.

Soon afta dat press conference of July 14, di cracks for di walls of di relationship between Dangote refinery and NNPC begin wide.

Remember say di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin don raid di Dangote Group office for Lagos in January dis year, sake of accuse around abuse of foreign currency allocations by di Central Bank of Nigeria.

Allegations and counter-allegations



Di Dangote Refinery tok say International Oil Companies (IOCs) for Nigeria no dey gree sell crude oil to dem, or dem go sell to dem for higher dan di official price set by NUPRC".

Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission na dem dey oversee activities for di upstream petroleum sector.

But di oga of NUPRC, Gbenga Komolafe, tok for one interview wit Arise TV say, "e dey erroneous" to tok say IOCs dey sabotage Dangote refinery.

E explain say di process of making crude avaialable to refiners na by "willing buyer, willing seller basis".

Also, di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority (NMDPRA) allege say di quality of di diesel wey Dangote Refinery dey produce dey low and inferior to di ones wey dem dey import.

According to di oga of NMDPRA, Ahmed Farouk di sulphur content of Dangote diesel dey higher dan 50 ppm (parts per million) wey be di recommended level for West Africa.

“Dangote refinery...dey produce between 650 to 1,200ppm. So, in terms of quality, dia product dey much more inferior to di imported quality,” oga Farouk tok for dat interview.

Oga Farouk also allege say "Dangote dey request make we suspend or stop all importation espcially of AGO and Jet Kero, and direct all marketers to im refinery. But dat one no dey good for di nation in terms of energy security, and e no good for di market bicos of Monopoly".

But Dangote deny di allegation on Sunday as e tok say im diesel na di cleanest for di Nigeria market.

“We dey produce di best diesel for Nigeria. E dey sad say instead of safeguarding di market, di regulator dey undermine am. Our doors dey open for di regulator to conduct tests on our products anytime; transparency dey paramount to us," Dangote tok afta some members of di Nigeria House of Representatives, including di Speaker, Tajudeen Abbas and im deputy Benjamin Kalu, visit di refinery.

Di latest now na one interview wey Nigeria online newspaper Premium Times bin publish on Monday wia dem tok say Dangote say e no go mind to sell im refinery to di Nigeria goment if dem go wan buy am.

"Make dem buy me out and run di refinery di best way dem fit. Dem don already call me a monopolist. Dat na incorrect and unfair allegation, but no wahala. If dem buy me out, at least, dia so-called monopolist go don comot for di way,” di local media quote Dangote as saying.

Steel investment don stop



Also recently, Aliko Dangote tok say im company don stop dia bifor bifor plan to go into steel production.

"Our board don decide say we no go do di steel (again) bicos if we do the steel business, dem go call us all sorts of names like monopoly, and den also, dem go encourage imports. So we no want go into dat.”

“Let other Nigerians go and do it. We no be di only Nigerians here. E get some Nigerians wwy get cash pass us,” e tok.

Remember say few months bifor di Dangote Refinery start work, Islamic clerics for Kano State, wia Dangote come from, bin organise prayers, for di success of di refinery, e be like say na now e go need di prayers more.

House of Reps don start investigation

Following dis back and forth wey dey happun between di Dangote Refinery and di NMDPRA, di Nigeria House of Representatives say dem don start an investigation to reach di root of di matter.

Ikenga Ugochinyere wey be Chairman of di House Committee on Petroleum Resources (Downstream), tell BBC Pidgin on Monday say di investigation don dey on di way wit di visit to di Dangote refinery facility on Sunday.

"Di matter na wetin we deliberate on, in di coming days we go make our findings public. Na me be di chairman of di committee wey dey investigate di matter. I no get any personal view on di issue, my own na to listen to everybodi, we go analyse wetin we get and we go announce our findings," Ikenga tok.

E no dey specific about when dem go conclude di investigation.

Wetin to know about Dangote and im refinery

Dem born Aliko Dangote for Kano in April 1967, to di wealthy Dangote and Dantata family.

E bin make im money for sugar and cement production bifor e com enter oil business wit dis im refinery wey e describe as im most challenging venture ever.

"If I bin know wetin I know now, I no for venture into building dis refinery," oga Dangote tok for one interview wit CNN.

According to Forbes Magazine, Dangote net worth na about $13 billion, wey make am di richest man for Africa.

Di Dangote Oil Refinery dey located for di Lekki Free Trade Zone, for Lagos State, na on May 22, 2023 dem inaugurate am.

Di facility dey sit on top land wey pass 2,500 hectares, and e fit process about 650,000 barrels of crude oil per day wen e dey work fully.

E mean to say di refinery na di largest single-train refinery for di world.

Wen e begin work fully, e fit provide 135,000 permanent jobs for di region.