BBC Pidgin of Friday, 25 October 2024

Source: BBC

All eight passengers die for helicopter crash for Atlantic ocean for Bonny

All di pipo wey dey inside di helicopter wey crash for Bonny, Rivers state don die All di pipo wey dey inside di helicopter wey crash for Bonny, Rivers state don die

All di pipo wey dey inside di helicopter wey crash for Bonny, Rivers state don die, authorities confam.

Di pipo wey die na di six passengers and two crew member.

Di federal ministry of aviation bin first report di helicopter accident wey happun on Thursday morning.

“Di helicopter, a Sikorsky SK76 wit registration 5NBQG and operated by East Wind Aviation, bin dey go from Port Harcourt Military Base (DNPM) to di NUIMANTAN oil rig,” di ministry tok for alert wey dem bin issue.

Dem say di aircraft enta inside water waters near Bonny Finima for di Atlantic Ocean.

Odutayo Oluseyi, tok tok pesin for di ministry of Aviation say three pipo die.

But hours afta search and rescue operation start, police for Rivers state, Southern Nigeria say all di pipo inside di helicopter don die.


But hours afta search and rescue operation start, police for Rivers state, Southern Nigeria say all di pipo inside di helicopter don die.

“Unfortunately, at about 11 am, di helicopter reportedly enta inside di ocean near Antan Producing Limited Mimbo platform and FPSO. All eight persons onboard don die,” Grace Iringe-Koko, Rivers state police tok-tok pesin write for statement.

Meanwhile, President Bola Tinubu don give order to di authorities to put more efforts to search for di passengers of di helicopter.

Inside statement wey Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga sign, President Tinubu condole wit di families of di pipo wey die, im also beg military officers wey dey do different operations for di zone to join di rescue mission and provide all necessary support to di Nigerian Safety Investigation Bureau (NSIB), di Nigerian Civil Aviation Authority, and oda relevant agencies.

"Di President condole wit di Board and staff of Nigerian National Petroleum Company (NNPC) and di families of all di pipo who wey dem don confam dead for di accident," di statement tok.

Accdording to police na oga Ifeanyi Udogwu, a staff of Antan Producing Limited, Port Harcourt, na im report to di Command say helicopter wit di call sign number 5N-BQG (S76C+), wey belong to East Wing Aviation crash.

Di Marine Division of di Rivers State Police Command say dem dey cooperate wit oda agencies to recover di aircraft and di occupants.

Olufemi Soneye, Chief Corporate Communications Officer NNPC Ltd for statement say "we go kontinu to monitor di situation and provide regular updates as di events unfold."

Helicopter crashes for Nigeria

Crashes of aeroplane no dey too common for Nigeria, but recently helicopters just dey crash and land anyhow for di kontri.

For December, 2023 one helicopter wey belong to di Nigerian Air Force bin crash for Port Harcourt wia all di crew members bin sustain injuries.

Di helicopter bin take-off early Friday morning on 1 December heading to Rivers state wit plan for one operation against wetin di force describe as ‘economic saboteurs’.

According to di director of public relations and information for di Nigerian Air Force, Air Commodore Edward Gabkwet, di crash bin happun around 7:45am Friday morning.

“A Nigerian Air Force (NAF) MI-35P helicopter bin crash for Port Harcourt today, 1 December 2023. Di unfortunate incident bin occur around 7.45am wey no too long afta di aircraft bin take off for one operation against economic saboteurs for Rivers State.”

Na five crew members bin dey inside di helicopter as at wen e crash but di director confam say dem dey safe wit ‘minor injuries and dem dey receive treatment.

For August 2023, one aircraft wey belong to di Nigerian Air force bin crash for Niger state.

Tori reveal say di aircraft bin take-off from Kaduna wia e dey go Minna before di crash happun for one village for Shiroro local goment Niger state.

For July 2023, di news of anoda crash bin comot again as one aircraft wey dem dey use train for di Nigerian Air Force crash for Benue state.

Although NAF tok say nobody die for di crash, but two pilots wey dey onboard land hospital sake of di crash.

Dat time, dem setup panel to investigate di cause of di crash wey involve a fighter jet belonging to di NAF.

For February 6, 2023, a maritime patrol aircraft crash land for Lagos. Di aircraft bin dey routine flight before e lose tyres wey make am control di landing go Murtala Muhammed International Airport, Lagos.