You are here: HomeAfricaBBC2024 07 12Article 1940119

BBC Pidgin of Friday, 12 July 2024

Source: BBC

Biden call Kamala Harris 'Trump' for one Nato conference

Biden mix up world leaders names two times- and make di case for why im fit beat Trump Biden mix up world leaders names two times- and make di case for why im fit beat Trump

US President Joe Biden mistakenly refer to Vice-President Kamala Harris as 'Trump' during one Nato press conference.

Di mistake bin come hours afta e refer to Ukrainian President Volodymyr Zelensky as “President Putin” while e dey speak to reporters about Nato support for Ukraine.

For di press conference, im also make case for why im go stay on for di presidential race and why e believe say im na di best candidate to defeat Donald Trump.

Joe Biden take to di stage for the press conference on Thursday night wia e tok about everytin around presidency, re-election hope, political life and im opponent.

For di hour-long session to mark di end of Nato summit, Biden tok plenti tins—even afta im earlier introduce Ukraine President Zelensky as "President Putin" for one separate event.

Di news conference na im first appearance wey no get script afta di debate wit rival Donald Trump, wey no too end well for am.

Na part of wetin lead to calls from several Democratic politicians and donors wey say make im drop out of di race for president.

E shake off concerns about im campaign wey reporters for di press conference ask am again and again.

For di news conference, e throway di rofor-rofor about im campaign wey reporters bin ask plenti times.

E promise say im dey fight to finish di job wey e start wen e take office for 2021.