BBC Pidgin of Wednesday, 15 January 2025

Source: BBC

Biden say bye bye from Oval Office as Trump dey set to take over

United States President Joe Biden go conclude im 50 years political career on Wednesday United States President Joe Biden go conclude im 50 years political career on Wednesday

United States President Joe Biden go conclude im 50 years political career on Wednesday wit one final Oval Office speech, wit hope say im go fit maintain achievements as Trump dey return to di White House.

Biden bin run for president for 2020, and at di age of 80 im bin wan contest for reelection, wit mind say im na di only Democrat wey fit beat Trump.

For July Democrats force am out of di race afta one disastrous debate against Trump.

Some of dem blame Biden for dia November wipeout, afta Vice President Kamala Harris bin collect di ticket and put togeda one sharp sharp campaign.

For im time, Biden goment bin oversee U.S. COVID recovery, fund infrastructure revival, spark new semiconductor chips manufacturing, plus tackle climate change as dem try to rebalance inequality and invest in di future.

Im dey leave behind U.S. economy wey don over perform, plus optimistic businesses.

But e get tins wey Biden bin no fit do during im time for office.

Im bin no fit heal divisions for di kontri di way wey im bin hope, or stop democratic backsliding around di world.

Im major achievement – defeating Trump for 2020 – bin only dey temporary.

Now di Republican president-elect don swear say im go change most of wetin di Democratic administration bin achieve.

For one letter wey White House release early on Wednesday, Biden address wetin im describe as ongoing threat.

"I run for president becos I believe say di soul of America bin dey at stake. Di very nature of who we be dey at stake. And, dat still be di case," im tok as e encourage Americans to kontinu fighting for di kontri focus on equality, life liberty and pursuit of happiness.

"All Joe Biden want na make dem remember am fo di great tins wey m do for dis kontri, at least for short time," David Axelrod, one of former President Barack Obama adviser tok.

"E become historic president wen im defeat Trump. So obviously di fact say Trump dey return to power, more powerful dan im bin dey wen im leave, na unhappy end to im story."

One White House official say dem dey set legacies over long term.

"In historical terms, na just few second since di election. Dis president lock in di most significant legislative record since LBJ, and di irreversible benefits of dis laws go grow over di years," di official tok.

Senator Chris Coons, one longtime supporter, say Biden bin face economic crisis, public health crisis, and democracy crisis afta di 6 January 2021 attack on Capitol by Trump supporters wen im enta office dat year.

"Di kontri bin dey for deep crises. Di recovery from pandemic na im single greatest accomplishment," Coons say.

Im administration oversee di distribution of COVID vaccines and an economic recovery even as inflation bin increase and prices remain high. Dis one provoke American voters.

Republicans seize di public frustration, provoke anger over high prices as e tell dem say Democrats dey disconnected from working class voters.

"You no fit reverse forty-five years of rising inequality wit few years of absolute good economic outcomes and policy changes," Heidi Shierholz, president of di Economic Policy Institute, tok. "But one of di most fundamental tins dem do na to provide relief recovery wey dem bin need to generate strong jobs recovery."

Biden, wey spend more dan thirty years for U.S. Senate and eight years as vice president to Obama before im four years as president, say unified Western response to Russia war wit Ukraine, making alliances or collabo wit oda kontris, and U.S. withdrawal from Afghanistan na major foreign policy achievements.

Thirteen U.S. military members died during di chaotic Afghanistan withdrawal for August 2021, and Biden popularity no ever recover.

Im unconditional support for Israel, wey kill tens of thousands of Palestinians in response to Hamas militant group deadly attack on di Jewish state, split di Democratic party, and Biden reputation suffer.

Vincent Rigby, na former senior national security adviser to Canada Prime Minister Justin Trudeau, dem go forever remember Biden as "interlude" president despite im solid achievements in rebuilding trust in United States afta Trump first term.

"We go see how history go treat am five, 10, 15 years from now, but dem go see am di president between di two Trump presidencies. Im bin hold di line, but Trump come back."