You are here: HomeAfricaBBC2024 07 08Article 1939530

BBC Pidgin of Monday, 8 July 2024

Source: BBC

Boeing go plead guilty to criminal fraud charge

Di families of pipo wey die from Boein plane crashes want make di DoJ prosecute di company. Di families of pipo wey die from Boein plane crashes want make di DoJ prosecute di company.

Boeing don gree say dem go plead guilty to criminal fraud conspiracy charge.

Dis dey come afta di US find out say di company no follow deal wey suppose reform dem afta dia 737 Max planes cause accidents wey kill 346 passengers and crew.

Di Department of Justice (DoJ) say di plane makers bin also gree say dem go pay criminal fine of $243.6m (£190m).

But di families of di pipo wey die for di accidents five years ago say lie-lie say dat kain deal na "sweetheart deal" wey go allow Boeing to dodge full responsibility for di deaths.

One pesin call am "atrocious abomination". E remain for US judge to approve di settlement now.

Boeing, as dem wan plead guilty so, go run from di show of criminal trial. Dis na sometin wey di victims don dey fight for.

Di company don dey inside hot soup sake of dia safety records since di two almost identical crashes wey happun wit 737 Max plans for 2018 and 2019. E make dem to ground dia planes all ova di world for ova one year.

For 2021, prosecutors charge Boeing wit one count of conspiracy to defraud regulators. Di charge accuse Boeing say dem deceive di Federal Aviation Administration (FAA) about dia MCAS flight control wey tori be say cause do two crashes.

Dem gree say dem no go prosecute Boeing if di kontri gree pay penalty and successfully complete three year period wey be say di level of monitoring and reporting go increase.

But for January, wey be say e remain small wey di period go finish, na im door panel for one Boeing plane wey Alaska Airlines dey operate blow comot just afta di plane take off. Di mata cause di plane to sharparly land.

No one wound for di incident but e increse di amount of torchlight wey pipo bin dey use look Boeing about how much progress Boeing true-true dey make to improve dia safety and quality record.

For May, di DoJ say dem find out say Boeing don vilate di terms of di agreement, wey mean say dem ffit face prosecution.

How Boeing guilty plea go affect dem

Boeing decision to plead guilty na still big stain for di company.

E mean say, dis company wey dey handle military contracts for di US goment, now don get criminal record.

Na also one of di two biggest companies wey dey make commercial jets for di world.

For now e no too clear how dis criminal record go affect di contracting business.

Di goment dey normally block company wey be sat get records make dem no dey part of bids bt dem fit also give waiver.

Paul Cassel, wey be lawyer wey dey represent some families of di pipo wey die for di Boeing crashes say, “dis sweetheart deal no gree recognize say bicos of Boeing conspiracy , 346 pipo die.”

E add say, “wit kurukere waka lawyering between Boeing and DoJ, di deadly consequences of di crime wey Boeing commit go hide.”

E ask di judge wey dey assess di deal, make im “reject dis yeye plea and set di mata to go public trial, so di facts wey dey surround dis case go dey heard for fair and open forum in front of jury”.

For letter wey oga Cassell bin send goment for June, e tell di DoJ make dem fine Boeing higher than $24bn.

Zipporah Kuria wey her papa die for one of di crashes call di plean say na "atrocious abomination".

She say, "miscarriage of justice na ogbonge understatement to call am, I hope say, God forbid, if sometin like dis happun again, di DoJ go remember say dem bin get opportunity to do sometin meaningful but no gree do am."

Ed Pierson wey be di executive director of Foundation for Aviation Safety, and former senior manager for Boeing say dis plea dey "seriously disappointing" and "terrible deal for justice."

E say, "instead of dem to gbab pipo and hold dem accountable, dem just give dem anoda get out of jail free card."


"Wetin carry Boeing reach dis stage?"

One Boeing 737 Max plane wey Indonesia Lion Air dey operate crash for late October 2018 just afta take-off wey kill all di 189 pipo inside.

Months later, one Ethiopian Airlines follow crash wey kill all di 157 passengers and crew wey dey inside.

For di 2021 deal, Boeing bin also gree say dem go pay $2.5bn make dem resolve di mata plus $243m criminal penalty and anoda $500m for victims fund.

Di deal vex family members no be small, on top say dem no follow dem tok on di terms of di deal and say dem don dey hala say make dem carry Boeing to stand trial.

CBS News wey be BBC US news partner report for June say senior staff for di DoJ bin dey ginger for prosecution.

For one hearing for June, Senator Richard Blumenthal say e believe say dem be "near overwhelming evidence" to go for prosecution.

Lawyers for di family members say di DoJ bin dey fear say dem no get strong case against di company.

Mark Forkner, wey be former Boeing technical pilot na di only pesin wey don face criminal charges from di incident.

Jury free am for 2022 as im lawyers tok say dem bin dey use am as scapegoat.

Mark Cohen wey be professor emeritus for Vanderbilt University wey study corporate punishments tok say prosecutors dey prefer plea deals or wetin dem dey call deferred prosecution agreements, bicos e dey ley dem avoid risk of trial and mean say goment fit get more power ova di company than if dem just sentence dem.

E say, "becos e dey easier to get pass going to trial, e fit reduce di load for prosecutor but di prosecutor fit also believe say na beta sanction sake of say dem fit put requirements wey no dey di normal sentencing guidelines."

E say e sure for am say di work wey Boeing dey do for goment as contractor na im add join di way di case take waka.

"Dem gatz reason wetin fit be di accidental results", na so im tok. "You no fit just take dis kain cases lightly".

Di mata of MCAS no go be di first time wey Boeing go clash wit di law.

Dem don also pay millions in penalties to di Federal Aviation Administration since 2015 to settle plenti cases of improper manufacturing plus oda issues dem.

Di company dey also face investigations and lawsuit on di mata of di door panel wey comot for di January Alaska Airlines flight.