BBC Pidgin of Tuesday, 22 October 2024

Source: BBC

Cameroon president finally show for public afta rumour spread say e dey sick

TV picture show as officials and supporters dey greet President Paul Biya for di airport TV picture show as officials and supporters dey greet President Paul Biya for di airport

Cameroonians don see 91-year-old President Paul Biya for public for di first time in six weeks for di middle of tok-tok about im bad health.

Im absence from di public eye bin lead to rumours of im death.

But on Monday afternoon, di state television bin show footage of di president arrival for di airport for di capital, Yaoundé, on one flight from Switzerland.

Di goment bin don ban media say make dem no discuss any tori wey relate to Oga Biya health as dem classify am as mata of national security.

President Biya don dey in power since in power since 1982.