BBC Pidgin of Friday, 25 October 2024

Source: BBC

Canada announce immigration plan wey go reduce temporary and permanent residents

Di plan go also torchlight permanent residents for di kontri. Di plan go also torchlight permanent residents for di kontri.

Canada govment don announce new immigration plan wey go reduce di number of international students and foreign workers.

Di plan go also torchlight permanent residents for di kontri.

Canada through di Honourable Minister of Immigration, Refugees and Citizenship, Marc Miller say di new plan dey important so dem go fit grow dia kontri economy.

"For di first time eva, di levels plan include controlled targets for temporary residents, specifically international students and foreign workers, as well as for permanent residents," di minister tok.

According to di Canadian govment, dis new plan go help dem prevent recession and also contribute to di workforce for Canada.

Di govment say dis reduction wey go affect international students go allow dem get tight requirements for dia eligibility so dem go fit attract 'best and di brightest.'

Meanwhile, Canada govment add say dem go move some temporary residents to permanent resident or to comot Canada compared to di new ones wey just dey arrive.

However, dis new plan, according to di minister na to reduce di pressure wey dey ontop housing, infrastructure and social services.

E say dem go welcome newcomers wey go preserve di integrity of dia immigration programs.

For di next two years (2025-2027), Canada say dem wan see reduction for dia population.

Dis plan na 'measures to attract some of di world best and brightest to study and work for Canada, and to make dem join di economy quickly', according to wetin Canada minister of Immigration tok.

"We dey reduce from 500,000 permanent residents to 395,000 for 2025; reduce from 500,000 permanent residents to 380,000 for 2026 and set a target of 365,000 permanent residents for 2027," di new plan show.

Dis mean say Canada dey reduce dia permanent resident targets.

For di temporary residents for Canada, di govment wan also reduce dem by 2026 as dem don already set new conditions for international students, foreign workers and dia spouses to cut down di rate of work and study permit.

Di conditions for international students wey dem set na say di target for study permit go reduce by 10% for 2025 and 2026.

Canadian govment put in place new limit on study and work permit for spouses of both foreign workers and students wey dey undergo master's and doctorate degree programs.

Na dis limit be part of di new immigration plan wey di Canadian govment dey implement so dem go fit reduce dia population by 2027.

For dis new immigration plan, Canada go reduce temporary resident from '445,901 for 2025; 445,662 for 2026 and a modest increase of 17,439 for 2027.'

Oda measures wey dey Canada immigration plan

1. Move more temporary residents wey don already dey for Canada as students and workers to permanent residents

Dis na sake of say dis residents don already get skills, education and sabi di Canadian society.

And according to di new plan, dis pipo go continue to support di workforce and di economy for Canada since dem don already get housing and employment.

2. To focus on long-term economic growth and key labour market sectors wey go include health and trades.

Canada say di permanent residents wey dem go admit go reach 61.7% by 2027.

3. To strengthen Francophone communities outside Quebec and support dia economic prosperity.

Di Canadian govment also include say dem go dey increase di number of permanent residents wey dem go admit from Francophone kontris.