BBC Pidgin of Monday, 14 October 2024

Source: BBC

Case of organ harvesting spark violent protest for Agenebode, youths burn police station

Di protesters also attack police stations and set am fire Di protesters also attack police stations and set am fire

Serious gbege na im happun on Sunday for Agenebode, headquarters of Etsako East Local Goment Area of Edo State.

Tori be say na plenty pipo die for di voilent protest over allegations of kidnappings and killings for di area by suspected criminals.

Di protesters also attack police stations and set am fire. Di youths of di area bin claim say police sabi wetin dey happun wit di killings and kidnapping for di area but decide to keep quiet.

Di pipo accuse police of providing cover for di suspected hoodlums.

Dem claim say di criminal elements bin dey kidnap and kill pipo for di area for suspected organ harvesting, wey make dem protest.

Kidnap of a young man burst alleged organ harvesting syndicate
Di incident wey lead to di violence, na di case of a young boy wey bin dey kidnapped some weeks ago and afta im pipo pay ransom, dem still no release am.

One eyewitness say di community youths bin track di phone and di user and dem arrest and hand dem over to di police, but in di process, dem trace di user to di head of a community for di area.

As dem no dey satisfied wit di way police handle di matter, di youths storm di police station and carry di suspect, wey come lead dem to di house of di community leader wia afta dem question am, allegedly confess say dem don kill and bury several kidnapped victims in shallow graves after dem harvest parts of dia bodies.

Di youths dig out di deadi body wey don dey smeel of one young man inside di compound of di man wey dem say na di community leader.

Also, while di youth bin dey dig di compound dem recover several bones believed to be those of human beings.

In anger, di youths go burn down di building and business centres of several pipo, and allegedly kill some of dem bifoe dem go attack di police station.

Assistant Inspector-General of Police (AIG) Zone 5, Arungwa Udo, and Commissioner of Police Edo State, Nemi Edwin-Iwo, don visit di area to restore order.

Also, di State Police tok tok pesin, SP Moses Yamu say dem go soon release official statement on di incident.