You are here: HomeAfricaBBC2024 08 25Article 1947408

BBC Pidgin of Sunday, 25 August 2024

Source: BBC

Chelsea go face Wolves for dia second Premier League game

Di Blues go visit Molineux Stadium wia Wolves go host dem for dia home Di Blues go visit Molineux Stadium wia Wolves go host dem for dia home

Chelsea go face Wolverhampton Wanderers for dia second Premier League game today Sunday 25 August, 2024.

Di Blues go visit Molineux Stadium wia Wolves go host dem for dia home.

Wolverhampton Wanderers boss Gary O'Neil no get any new fitness issues as dem await Chelsea visit.

Nelson Semedo go miss out sake of suspension, while Leon Chiwome, Sasa Kalajdzic and Enso Gonzalez remain long-term players wey go dey absent.

Chelsea new signing Joao Felix go dey available to play, even head coach Enzo Maresca neva decide whether di Portugal player go start from di first half.

Reece James dey serve di third game of four-match suspension wey dem sama am afta dem send am off for di end of last season.

Match facts



Head-to-head

Wolverhampton Wanderers don win di past three Premier League meetings, as many as dem play for ida previous 17 attempts (Draw 4, Lose 10).

Chelsea neva get any away win for four league games against Wolves since dia 5-2 victory for September 2019 under Frank Lampard (Draw 1, Lose 3).

Di Blues last win ova Wolves bin come for Stamford Bridge for October 2022 wit goals from Kai Havertz, Christian Pulisic and Armando Broja.

Wolverhampton Wanderers

Wolves don lose four successive Premier League games for di first time since dia run of six from May to August 2021.

Dem don win only one of dia last 12 competitive matches for all competitions since dia 2-1 top-flight home victory against Luton for April (Draw 2, Lose9).

Wolves no get any English player for dia line-up against Arsenal and dis na di first time wey e go happun for Premier League fixture.

Rayan Ait-Nouri wey be 23 years and 80 days fit become di youngest player to make 100 Premier League appearances for Wolves. Di record wey Pedro Neto of Chelsea dey currently hold.

Chelsea

If dem no defeat dia opponent, Chelsea fit lose dia opening two games of one league season for di first time since 1973-1974.

Enzo Maresca fit become di first Chelsea manager to lose first two top-flight fixtures for di club since Gianluca Vialli lose di first three for 1998.

Di Blues don fail to keep one clean sheet for any of dia last 18 away games for all competitions since dia 2-0 Premier League win for Fulham last October.

Goal for Pedro Neto go make am just di fourth player to net one Premier League goal for and against Wolves, afta Stephen Hunt, Diogo Jota and Morgan Gibbs-White.

Wit Chelsea over 40 players for dia squad, e never clear who and who go play as di club manager, Enzo Maresca don tok say make some of im team members go find club to join as dem no be part of im plan for di blues.