Di death toll from di wildfire for Los Angeles don rise to 24 wit16 pipo missing, officials tell BBC.
Dem find sixteen of di body for Eaton fire zone, while dem find eight for Palisades area.
Weather forecasters for California don warn say di wind wey fuel di fire around Los Angeles fit pick up again dis week, as di fire crews try to make progress to control di three wildfires.
Forecasters say di Santa Ana winds fit start again from Sunday night until Wednesday, reaching speed of up to 60mph (96km/h).
Officials don dey make progress to stop di spread of di deadly Palisades and Eaton fires, wey dey burn on opposite end of di city.
Firefighter from eight oda states, as well as Canada and Mexico, continue to assist local firefighters as dem dey arrive.
Officials tell BBC say di fight against di fire neva end and di fire fit "take off on Tuesday or Wednesday wit di increased wind conditions".
Dem don arrest 29 pipo for looting form di mandatory evacuation zones. Two pipo dey pose as firefighters so dem go fit steal from evacuees.
Los Angeles County Sheriff Robert Luna for one news conference on Sunday say e don request for more National Guard troops to allow di 400 wey dey on ground to rest.
California govnor, Gavin Newsom don announce say dem don deploy additional 1,000 members of di National Guard.
"Wen I dey out dia in di Malibu area, I see one gentleman wey look like firefighter. And I ask am if e dey okay becos e dey sit down. I no realise say e dey in handcuffs," Sheriff Luna tell tori pipo.
"We go turn am ova to LAPD becos e dress like fireman, and e no be fire man. Dem catch am as e dey forcefully enta pesin house. So dis na di are issues wey front-line deputies and police officers dey deal wit."
Largest fire for Palisades na just 13% e contain
According to di Californian fire authority na three wildfires dey burn. Di largest na, Palisades, e don burn through more dan 23,000 acres and e contain 13%.
Di second biggest na Eaton, e don burn through more dan 14,000 acres and e contain 27%.
Di Hurst fire don grow to 799 acres and e contain 95%.
Di Palisades and Eaton Fire continue to burn as dem place105,000 pipo under evacuation orders. For evacuees we dey unsure weda di fire spare dia homes, dem dey wait for di announcement say e dey safe for dem to return home.
On Sunday, private forecaster Accuweather increase dia preliminary estimate of financial loss from di fire , e dey betwin $250bn-$275bn.
Wetin we know about LA fires victims?
At least 16 pipo don die as wildfires burn for Los Angeles and fear dey say di number fit rise.
Officials say e fit may take several weeks to identify victims as traditional methods like fingerprinting and visual identification fit no dey possible.
Victor Shaw
Victor Shaw die trying to defend im house from di wildfire in Altadena, im family tok.
Dem find di 66-year-old body on di side of di road by im property, wit garden hose for im hand.
Randall "Randy" Miod
Miod die for im Malibu house, im mama Carol Smith tell CNN.
Di 55-year-old tell Smith on Tuesday e go get di garden hose ready to protect di house, wia e bin dey live for decades, from di fire.
Anthony Mitchell and im son Justin
Anthony Mitchell and im adult son Justin die for dia home in Altadena as dem dey try to escape di wildfires, dia family tok.