BBC Pidgin of Wednesday, 9 October 2024

Source: BBC

Di future of Kenya Deputy President wey Senate wan consider im impeachment

Kenya Deputy President Rigathi Gachagua Kenya Deputy President Rigathi Gachagua

Di Senate dey expected to announce dia resolution on di proposed removal from office of Kenya Deputy President by impeachment soon.

Dis dey come afta majority Members of Parliament (MPs) bin adopt one 11-charge impeachment motion wey vote for di removal of di deputy president, Rigathi Gachagua.

On Tuesday evening, National Assembly Speaker Moses Wetangula bin announce say 282 MPs bin support di impeachment motion, while 44 MPs oppose di motion, one MP bin dey neutral.

Di speaker don send di decision of di lawmakers give di upper house and di lawmakers dey expect to investigate di charges against di deputy president and uphold or reject di impeachment motion.

Di embattled deputy president dey face accuse of corruption, undermining di goment and say e dey promote ethnically divisive politics.

If two-thirds of senators approve di charges, Gachagua go lose im post and e no go fit hold any public office for future.

Charges against Deputy President, Rigathi Gachagua

Lawmakers bin accuse Rigathi Gachagua say e dey do ethnically divisive politics and dey undermine di goment.

Dem also accuse am say e acquire properties through corrupt means. Dem claim say e gada assets wey worth 5.2bn Kenyan shillings ($40m, £31m) in two years inside unexplained wealth.

However, di vice-president, wey be wealthy businessman clear am say, most of di houses and land belong to im late brother estate.

Those wey support di allegations allege say Rigathi Gachagua bin dey get hand for di June anti-government demonstrations – wey turn turned deadly.

Also di lawmakers bin write 11 charges against di Deputy President wey dem submit give di Senate.

Part of di charges include:

*Gross violation of 160 (1) of di constitution and decisional independence of judges.

*Srious reasons to believe say di deputy president don commit crimes under sections 13 (1)(a) AND 62 of di National Cohesion and Integration Act

*Gross misconduct by persistently bullying state and public officials.

*Gross misconduct by openly or publicly insubordinating di president, wey be di head of state and goment


'I dey innocent of all these charges' - Gachagua

Di 59-year-old politician, wey pipo sabi as “Riggy G”, don describe di allegations against am as "outrageous" and "sheer propaganda".

Gachagua don deny any wrongdoing for im recent fallout wit President William Ruto.

For one televised speech on Monday, e condemn Mwengi Mutuse, di MP wey draft di motion, as e call di move “shameful and sensational”.

"I dey innocent of all these charges," Gachagua tok.

"I no get any intention whatsoever to resign from dis job. I go fight to the end."

E defend di controversial renovation for im official residence for di capital.

Gachagua bin go court to stop di impeachment proceedings several times, but e fail.

On Sunday, Gachagua bin beg President William Ruto and di MPs to forgive am for any wrongdoing during im tenure.

E later clear am say im apology no be admission of guilt.

Ruto neva comment about di impeachment motion publicly, but e dey on record for di early days of im presidency wia e tok say im no go ever publicly humiliate im deputy.

Steps to impeach vice president for Kenya

For dis particular case, a total of 291 MPs, more dan di 117 wey dey required by di constitution, bin sign di motion to initiate di impeachment for early October.

Di motion bin list 11 grounds for impeachment, wey include accusations say Gachagua bin amass assets wey worth 5.2bn Kenyan shillings ($40m, £31m) in two years in unexplained wealth.

Wen MPs wan take big decisions, di constitution tok say dem first must consult di public.

According to one parliamentary report, dem receive more dan 200,000 responses as part of dat process - of which 65% support Gachagua impeachment, while nearly 34% oppose am.

For di motion to pass, e go require di support of at least two-thirds of members of di National Assembly and Senate, apart from dia nominated members.

According to di constitution, di following na grounds to remove di Deputy President from office; on di ground of physical or mental incapacity to perform di functions of di office; or on impeachment.

For Kenya constitution, bifor lawmakers go fit impeach or remove Deputy President, dem must don do di following;

*Afta di mover and di defender of di motion don present dia arguments finish, members of di House go vote on am.

*If 233 members of parliaments support di motion, di Speaker go send am to di Senate within 2 days.

*But if e fail to get up to 233 votes from di MPs, den na dia dis mata go die.

*Also, if 117 MPs reject am, di vice president go remain in power

*If e reach Senate, within seven days, di Senate Speaker go convene sitting of di National Assembly Resolution.

*Senate fit to decide say e go establish 11 member committee or plenary.

*Which ever one e decide, Senate must to finish everything concerning investigation, hearing, and voting on di impeachment inside 10 days.

*At least 45 Senators must to vote in favour of di impeachment charges for am to stand, or for dem to fit remove di deputy president.

Who fit replace Rigathi Gachagua if Senate uphold im impeachment

According to Kenya constitution, within fourteen days di office of Deputy President become vacant, di President go nominate one pesin to fill di vacancy, and di National Assembly go vote on di nomination within sixty days afta dem receive di pesin name.

Who be Rigathi Gachagua - Kenya Deputy President

Bifor e dey elected MP for 2017, many pipo no too sabi wey go in five short years, rise to become Kenya second-in-command.

Na only few pipo outside Gachagua central Kenya constituency bin don hear of am or im style of politics.

Gachagua bin capture di limelight for di run-up to di 2022 elections, wen e strongly oppose President Uhuru Kenyatta choice of preferred successor.

Ruto chose Gachagua as im running-mate for di 2022 election, wen e defeat former Prime Minister Raila Odinga inside one bitterly contested election.

Gachagua come from di vote-rich Mount Kenya region, and help gada support for Ruto.

Gachagua, na wealthy businessman from di vote-rich Mount Kenya region.

E come from Kikuyu community, di kontri largest ethnic group, while President Ruto na from Kalenjin, one ethnic group wey dey for di Rift Valley.

These two communities bin dey at loggerheads afta elections for 2007 - ethnic violence wey lead to di death of 1,200 pipo for nationwide.

Bifor e become Kenya deputy president, police bin raid Gachagua house and arrest am in connection to a corruption and money-laundering case.

Dem drop di charges aft aim and Ruto bin take ova power afta di 2022 election.

For 1989, then Vice-President Josephat Karanja bin resign from office wen e face similar motion.