BBC Pidgin of Tuesday, 24 December 2024

Source: BBC

Drug lord Pablo Escobar senior lieutenant return to Colombia afta 20 years inside US jail

Fabio Ochoa Vasquez return to Columbia afta 20 years Fabio Ochoa Vasquez return to Columbia afta 20 years

One of di founders of di Medellin drug cartel don return to Colombia afta serving more dan 20 years in jail for US for drug trafficking.

Di US goment bin deport Fabio Ochoa Vasquez, wey dey 67 years now, and in bin land for Bogota on Monday as a free man.

Ochoa na one of di founding members of di notorious cartel and im be senior lieutenant to infamous drug lord Pablo Escobar.

Di Medellin cartel bin dominate di cocaine trade and bin wage violent campaign against di Colombian state bifor dem bin kill Escobar for 1993.

Wen in arrive Bogota, immigration officials bin put Ochoa fingerprints through dia database, na wetin immigration agency for di kontri tok.

Dem confam say even though Colombian authorities no want am, Ochoa dey free "to reunite wit im family". Authorities tok.

In di midst of plenti reporters for di airport terminal, Ochoa relatives greet am and im hug im daughter.

For 2001, dem bin fly Ochoa to di US afta dem arrest am for Colombia in 1999 along wit about 30 oda alleged traffickers.

Im bin don already serve one jail sentence for Colombia in di early 90s for im role as one of bosses of di Medellin cartel.

Along wit im brodas, im be di first major trafficker to surrender under one programme wey bin dey protect cartel members from extradition to di US if dem bin plead guilty to minor offences for Colombia.

Dem bin release Ochoa and im brodas from prison in 1996, but dem re-arrest Ochoa during di so-called Millennium operation sake of say im get hand for cocaine smuggling business for di US in di late 1990s.

For 2003, One US court bin sentence Ochoa to more dan 30 years sake of im involvement for di cartel wey bin bring an average of 30 tonnes of cocaine into di US evri month between 1997 and 1999.

During di 1980s, im be one of di top operators for Escobar Medellin ring, na supplier for im prime, wit 80% of di US cocaine market.

Di Medellin cartel wey no dey exist again, along wit di Cali cartel, na one of di most powerful and feared drug networks during di1980s.

Dia violent campaigns of bombings and assassinations bin lead to extraditions of drugs suspects between Colombia and di US wey force dem to suspend am, bifor dem start again in 1997.