You are here: HomeAfricaBBC2024 06 05Article 1934332

BBC Pidgin of Wednesday, 5 June 2024

Source: BBC

Families demand answers from police over strange disappearance of Celine and Afiba

Celine Ndudim and Afiba Tandor dey missing since afta dem go visit one man for Aba, Abia State Celine Ndudim and Afiba Tandor dey missing since afta dem go visit one man for Aba, Abia State

Families of two girls Celine Ndudim and Afiba Tandor wey dey missing since afta dem go visit one man for Aba, Abia State for Southeastern Nigeria say dem believe say di girls still dey alive.

Tessy Ndudim, sister to Celine tell BBC News Pidgin say na since 27 April 2024 dem declare dem missing and dem dey beg di police and Nigerians in general to help find di girls and return dem safely.

Dis dey come afta police authorities say dem don recover one deadibodi for a place close to wia di girls bin share dia last location bifor dia phones off.

How di mata happun?

Tessy Ndudim say na on 27 April 2024 na im she get call from her sister friend say di man wey her sister Celine and her friend Afiba go visit don kidnap dem, so she travel go Aba, Abia State go report for police.

She say her sister Celine and her friend Afiba bin go visit one man, Andrew Amechi for Aba but dem later send a WhatsApp message to one of dia friend say di man don kidnap dem so make dem call police and cry for help.

She say she share dis information wit di police wen she go report di mata but di police no do anytin serious about am.

"Di Police for rescue my sister and her friend dat week wey I go report to dem but dem no take am serious becos dem dey tell me say na gradual process and wia ever dem dey dem no go injure dem.

"But I insist and dem finally go for search for di area wia dem share dia last location but wen we reach dia, dem search some buildings and di particular building wey I dey insist make dem check becos I see di car wey look like di one wey we see for CCTV for di hotel wey come pick dem for Aba dia.

"Di police say dem go do anoda search around 2am di next morning. Dem go and come back to tell me say dem no see anytin."

Tessy say dis response from di police make dem petition Police Zone 9 for Umuahia and na dem wey give order to Umuahia Command make dem go do dia own research for dat same location wey di girls share bifor dia phones off.

"Di Umuahia Command na im go and catch dis man for dat building wey I bin lament say I see di car wey dey like di one wey come carry dem for hotel CCTV and na dia dem catch Andrew Amechi." She tok.

She add say di news don really affect dia family as dia mama dey down since di news break.

She also appeal to Abia State Goment to chook eye for di mata as many pipo don report about similar issues and plenti tins dey go in wey di goment suppose torchlight.


‘I no believe say my wife don die’ - Afiba husband

Afiba Tandor di second girl wey dey missing na citizen of Ghana wey come visit her friend Celine Ndudim and dia two go visit Andrew Amechi after e invite dem to come but shortly after di visit, dem send cry for help say Amechi don kidnap dem.

Afiba husband tell BBC News Pidgin say e no happy wit di way di police dey handle di mata as e don pass one month wey dem report di kidnap of im wife and her friend but till now dem neva still see dem.

E say e bin dey in contact wit im wife from di time she and her friend Celine travel from Accra Ghana go Lagos den from dem travel go Owerri bifor dem come Port Harcourt and travel to Aba to go see Celine friend but e come dey worried wen she no respond to chat wey e send her and di next day, a friend of Celine inform am saying di pesin wey dem go visit don kidnap dem.

E say e reach out to Celine family members wey go report di mata to police for Aba and e dey follow all di tins wey don happen with di police so far.

E say e no believe di tori wey police bring out say dem don recover di deadibodi of one of girls unless dem give am scientific and DNA proof say dat pesin na in wife.

"I no dey happy and I no believe say my wife don die. If I believe say my wife don die I go dey tok to you like dis? Make di Nigeria ln police do evritin to rescue my wife and her friend. Na beg I dey beg dem," e tok.

E say e don report di mata to both di Ghana High Commission and Nigerian Embassy and e dey beg dem to do evritin to rescue im wife alive and safe.

Andrew Amechi don die?

On Friday 31 May 2024 tori come out say Andrew Amechi die wen police bin dey transfer am from Aba to Abuja wen some vigilantees open fire on dem and in di process e die.

Di pipo wey allegedly kill Andrew dey police custody.

Afiba husband say, "I no believe am at all say Andrew Amechi don die until police show me im deadibodi and dem put hand for im neck and show me ogbonge proof say e don die, I no believe am!

Andrew Amechi na sociopath wey di British Police also don declare wanted so no be pesin wey police go handle like small pikin. Make dem find way rescue my wife and ensure say justice dey served for dia mata." E tok.

On di discovery of di deadibodi wey police say dem discover for wia di girls share dia last location, both Afiba husband and Celine sister say dem no believe say na either of di girls.

"Wetin be dia proof say dat corpse belong to any of di girls? Dem carry any forensic team go dia? Until dem give me DNA proof say dat pesin na my wife, I no believe am." Na so Afiba husband tok.

Tessy Ndudim also say dat bodi no be her sister as di deadibodi dem recover don dey decompose wey indicate say di pesin don die well before di time wey she go report to di police as e na just dey over five weeks ago.

Police and some human rights activists go search di area wia di missing girls share dia last location and recover one deadibodi wey dey wrapped with cloth wey dey like di curtain for Andrew Amechi house.

Tori be say di deadibodi dem recover dey beheaded with oda body parts missing and di police say dem go subject am to DNA testing to confam.

Nigerian Police neva release any official statement on dis issue and dem also never responded to any of our enquiries.


Celine Ndudim meet Andrew Amechi online for social media and dem don dey chat for some time before e invite her to visit am for Aba



Afiba Tandor na Ghanaian wey follow her friend Celine Ndudim go visit Andrew Amechi for Aba, Abia State