You are here: HomeAfricaBBC2024 09 04Article 1949106

BBC Pidgin of Wednesday, 4 September 2024

Source: BBC

Father demand justice from school afta fellow student allegedly stab im son to death

Di papa say di student allegedly carry knife take stab di deceased wey im name na Edward Di papa say di student allegedly carry knife take stab di deceased wey im name na Edward

Father of 18-year-old final year student of O’Reilly senior high school for Ghana don dey demand answers from di school afta one student allegedly stab im pikin to death.

Tori bin dey go round say di boy wey don die bin get kwanta wit anoda student for campus wey bin turn fight on Monday, as im and oda final year students dey write dia West Africa Senior School Certificate Exams (WASSCE).

Di papa say di student allegedly carry knife take stab di deceased wey im name na Edward.

“As I go di hospital afta I receive one call say dey carry my pikin go dia, di doctor tok say im die. I see say im get three stab wounds for im chest,” Edward papa Enoch Sackey tok.

Im tell journalists afta im visit to di school say “di school neva tell us anytin. I bin dey here all day but dem carry police come di campus wey dem no dey tell us anytin.”

“Di school gatz to tok to me di papa of di pikin, di family of di boy wey (allegedly) kill my pikin too neva call me to tok anytin. Dis na sad tin.”

Enoch Sackey say im family go hold di school responsible ova di death of im son, sake of dem sabi “protect our children on campus. If dis tin fit happun for dia, dem gatz explain to us. We go take legal action against dem.”

Afta one meeting, di regional director of education Stephen Abamfo bin tok say dem go investigate di mata.

Im also tok say dem go put tins in place “to ensure safety of students and staff for di school.”

Meanwhile, di student wey allegedly stab di deceased dey for di hand of di police.