You are here: HomeAfricaBBC2024 06 02Article 1933797

BBC Pidgin of Sunday, 2 June 2024

Source: BBC

Final results from South African show ANC party lose parliamentary majority

Di results for the elections come through Di results for the elections come through

Di electoral commission for South Africa don announce how di seats go dey distributed for di 400-member National Assembly.

Here na di top parties:

ANC - 159 seats

DA- 87 seats

MK - 58 -seats

EFF - 39 seats

IFP - 17 seats

PA - 9 seats

Di remainder of di seats bin go to smaller parties.

Dis confam say ANC go need to do coalition to form di next government.

Di Chairman of di electoral body Mosotho Moepya, afta di announcement tok say di 2024 elections dey "free and fair".

"Let us celebrate dis achievement as we remain vigilant - for di work of strengthening democracy na one wey no dey ever end."

How dem dey form coalition for South Africa?

Di constitution no spell out how dem fit form coalition if no party get more dan 50% of di vote.

But assuming di ANC remain di largest party, smaller parties fit informally agree to support ANC government on a vote-by-vote basis in return for some concessions.

Or, at di oda end of possibilities, di ANC fit enta formal coalition wit some parties, including a written agreement wey go outline legislative plans and di distribution of cabinet posts.

Any oda party go face di same choices.

How general elections take dey work for South Africa?

Di number of seats dem dey allocate give parties for di 400-member National Assembly dey directly related to dia share of di vote.

For 2024, dem include independent candidates for di first time.

Dis one mean say South Africans bin get three votes:

- National parliament: One for 200 of di seats wit just political parties wit dia name on di ballot
- National parliament: One for di remaining 200 seats wit a different ballot paper for each of di nine provinces, wey go list di parties for dat region and independent candidates
- Provincial assembly: One for di independent candidates or parties for di regional legislature