Mia Love, di first US black Republican congresswoman, don die at di age of 49 for Utah, her family don announce.
"She die peacefully" on Sunday, surrounded by family for her house for di town of Saratoga Springs, one statement tok.
Love na daughter of Haiti immigrants wey bin represent di state of Utah for US House of Representatives.
Her daughter Abigale bin tok before say Love no dey respond to treatment for brain cancer.
"Inside di celebration of her life plus plenty happy memories, Mia quietly leave dis world and, as her words and vision dey always do, she float go heaven," di family statement, wey dem bin post on X tok.
Paying tribute to Love, Utah Governor Spencer Cox write: "True trailblazer and visionary leader, Mia inspire plenty countless Utah pipo through her courage, grace, and storng belief in di American dream.
"Her legacy go leave lasting, positive impact on our state. We go miss her deeply."
Mia Love political career bin officially begin for 2003 wen she win seat for di Saratoga Spring city council, and she later become di mayor at di age of 34.
For 2014, dem elect her to di US House of Representatives. She make history as di first black Republican woman to win di seat, and she bin serve two terms.
Love bin criticise Donald Trump wen im bin run for president for 2016, endorsing instead im Republican nomination rival, Texas Senator Ted Cruz, wey bin later drop out of di race few months later.
She also bin ask Trump to publicly apologise for making derogatory comments about Haiti for 2018.
Her attempt to come back for third term bin end for one techere defeat to her Democratic rival Ben McAdams.
Trump react dat time wey she no win by saying for one news conference: "Mia Love no give me love, and she lost."
Before entering politics, di mama of three pikin bin work for some time as a flight attendant.
As teenager, she bin dream of becoming actor, but later she graduate from University of Hartford for Connecticut with degree in musical theatre.
For 2022, doctors discover say Love get wetin dem call glioblastoma, one fast-moving and aggressive form of brain cancer, and dem bin give her just 10-15 months to live - but she live pass like dat.
Her death dey happun nearly two weeks afta Love write one opinion piece for Deseret News, wey she say, she no write am "to say goodbye but to say thank you and express my living wish for you and di America wey I know".