You are here: HomeAfricaBBC2024 06 05Article 1934324

BBC Pidgin of Wednesday, 5 June 2024

Source: BBC

From cartoon to human AI, Jadrolita tok how she turn mockery to content

Nigerian content creator, Amadou Elizabeth Aminata, wey pipo sabi as Jadrolita Nigerian content creator, Amadou Elizabeth Aminata, wey pipo sabi as Jadrolita

Popular Nigerian content creator, Amadou Elizabeth Aminata, wey pipo sabi me as Jadrolita follow BBC News Pidgin tok about her journey as human AI and why she enta dis kain content creation.

Jadrolita say from her childhood pipo dey tell am say she dey behave like cartoon but she bin dey see am as mockery bifor she decide to use am for her own financial gain.

Di content creator say her AI character and her natural behaviour dey veri similar and add say difference no too dey sake of say na raw talent.

"My human sef and AI character kind of dey similar. So sometimes as I dey act as human e be like say I dey act as AI. So too much difference no too dey na just me be dat and na raw talent.

"Becos I be AI right from small pikin e no hard me at all. As I come grow I come see creator wey activate me to be like dis now. You like am abi?" she tok.

On her relationship wit TikTok influencer Peller, she say both of dem na good friends wey fans dey like to see dia contents togeda.

“Peller! Peller na my veri good friend for dis content creating and I don know am for long. Just be say fans like di two of us togeda based on say we understand fans, we dey give dem wetin dem want make dem see,” she tok.

Human AI imitation

Afta Jadrolita become popular for her AI content on di Nigeria social media space several content creators begin imitate di character and begin act like human AI.

Jadrolita tok say she no dey feel bad say content creator like herself dey imitate her content, if e dey work for dem.

She say she bin face criticism from netizens wen she bin begin her journey as human AI becos e dey new to Nigerians and pipo bin dey laugh am bifor dem begin accept di character.

Reacting to pipo wey dey yarn say her human AI content no go last, Jadrolita say she don commit her journey to God hands.

"Normally, tins dey come tins dey go, evritin get time evritin get season as my own time come, wen God tok say na dis time e go reach, e go reach, if God tok say e go continue, e go continue.

"Evritin dey God hand. No be me go decide dat one for anyone wey dey tok like dat make dem chill. Na God get power," she tok.


Afta Jadrolita become popular for her AI content on di Nigeria social media space several content creators begin imitate di character and begin act like human robot.