You are here: HomeAfricaBBC2024 07 09Article 1939766

BBC Pidgin of Tuesday, 9 July 2024

Source: BBC

How Canada become di headquarter of car theft for di world

Car theft Car theft

Logan LaFarniere bin wake up one morning for October 2022 to see empty driveway.

Im brand new Ram Rebel truck dey miss.

Logan security camera capture two men wey cover dia face as dem enta di pickup for midnight outside im Milton, Ontario home, and drive am away wit ease.

Few months later, dat same truck bin appear on one website of vehicles for sale for Ghana, one ocean and some 8,500km away.

“Wetin make me know say na my truck na di laptop holder wey I install for di driver seat for my son, and inside na di yamayama e put inside.” Oga LaFerniere bin tell BBC.

“I no get doubt for my mind, I know say dat na my vehicle.”

Oga LaFarniere story dey almost similar wit dat of odas.

Dem tiff ova 105,000 cars for Canada for 2022 - Canada authorities

For 2022, dem tiff more dan 105,000 cars for Canada – dem dey tiff about one car every five minutes.

Among di victims na Canada very own federal justice minister, wey jaguda pipo don tiff im government-issued Toyota Highlander XLE two times.

Early dis summer, Interpol bin list Canada among di top 10 worst kontris for car thefts out of 137 kontris for dia database - a “remarkable” feat, according to one tok-tok pesin, considering say di kontri just begin update dia data wit di international police organisation for February.

Authorities say once dem tiff di cars, dem dey either use am carry out oda violent crimes, sell am domestically to oda unsuspecting Canadians, or ship am go overseas wia dem go resell am.

Interpol say dem don detect more dan 1,500 cars around di world wey dey stolen from Canada since February, and dem dey identify around 200 more each week, usually for ports for oda kontris.

Di car theft mata serious so tey, di Insurance Bureau of Canada declare am as “national crisis”, dem say insurers gatz pay out more dan C$1.5bn ($1bn; £860m) for vehicle theft claims last year.

Di problem don force police jurisdictions across di kontri to issue public bulletins on how to protect vehicles from theft.

Meanwhile, some Canadians don take mata into dia own hands, as dem dey do everything to prevent car theft, from installing trackers on dia cars to hiring private neighbourhood security.

Some pipo wey fit afford di money, don even install retractable bollards for dia driveways – e be like those wey dem dey put for banks and embassies - to prevent robbery.

Victim of car theft share im experience


Nauman Khan, wey dey live for Mississauga, one city just outside Toronto, bin start bollard-installation business afta im and im brother become victims of car thefts.

For one attempt, Oga Khan tok say thieves bin enta im house wen im wife and young children bin dey sleep. Dem tok say dem dey look for di keys to im Mercedes GLE wey e park outside, e tok , but dem run afta e shakara dem.

Afta dat “traumatic” experience, dem sell all dia cars except for two “humble” family vehicles.

Through im business, Oga Khan tok say im now dey dey hear similar stories from pipo for di region of Toronto.

“We bin get one client wey jaguda pipo dey disturb im street well-well, e gatz employ security man wey go dey guard im house every night as e no just feel safe.”

Di rate at which dem dey tiff cars for Canada dey surprising, given how di kontri population dey small compared to di US, UK – and oda kontris wey get high rates of dat kain crime, Alexis Piquero, Director of di US Bureau of Justice Statistics tok.

“[Canada] also no get many port cities like di US,” Mr Piquero add.

While di US, Canada and UK don experience increase in car thefts since di Covid-19 pandemic, Canada rate of thefts (262.5 per 100,000 pipo) high pass dat of England and Wales (220 per 100,000 pipo), according to di latest available data from each kontri.

E dey fairly close to dat of US, wey dey around 300 vehicle thefts per 100,000 pipo, based on 2022 data.

Di rise in recent years partly na becos shortage dey for cars sake of di pandemic, plus increase dey for di demand of used and new vehicles all ova di world.

Also, growing market dey for certain car models internationally, wey don make auto theft top revenue generator for organised crime groups, Elliott Silverstein, director of government relations for di Canadian Automobile Association tok.

But Oga Silverstein say di way wey Canada ports dey operate don make dem more vulnerable to dis kain theft pass oda kontris.

“For di port system, greater focus dey on wetin de yenta di kontri pass wetin dey comot di kontri,” e tok, e add say once dem don pack di vehicles inside shipping containers for port, e go dey hard to see dem.

Police have managed to recover some stolen cars.

For October, Toronto Police Service announce one 11-month investigation wia dem take recover 1,080 vehicles wey worth around C$60m. More than 550 charges were laid as a result.

And between mid-December and di end of March, border and police officers see nearly 600 stolen vehicles for di Port of Montreal afta dem inspect 400 shipping containers.

These types of operations, however, fit dey difficult to carry out given di volume of merchandise wey dey move through dat port, experts tok.

Around 1.7 million containers bin move through di Port of Montreal for 2023 alone.

Port staff also no get di authority to inspect containers in most cases, and in customs-controlled areas only border officers fit open container without warrant.

For di same time, di Canada Border Services Agency (CBSA) dey faced wit chronic understaffing, according to one report wey dia union submit give government for April.

Outdated technology also na issue.

Patrick Brown, di mayor of Brampton - anoda Ontario city wey issue of car theft plenty – bin recently paid Port Newark Container Terminal for New Jersey to compare inspection tactics between US and Canada.

E tell National Post newspaper say US authorities “get scanners. Dem dey measure density. Dem also dey work closely wit local law enforcement”.

“These na things we no dey do for Canada,” e tok.

For May, di Canadian government say dem go invest millions to boost di CBSA ability to search ship containers. Police go also get additional money to combat auto theft for dia communities.