BBC Pidgin of Thursday, 24 October 2024

Source: BBC

How Siya and Rachel Kolisi announce end of dia marriage

Siya Kolisi and im wife Siya Kolisi and im wife

Di captain of South Africa national Rugby team Springbok, Siya Kolisi and im wife Rachel don announce say dem don decide to end dia marriage.

Siya Kolisi and im wife wey marry for 2016 anounce di end of dia marriage inside joint statement wey dem release on social media.

Dem get two children togeda, dia son Nicholas Siyamthanda and daughter Keziah, plus Siya younger half-siblings Liyema and Liphelo wey dem adopt.

According to local media dem dey separate months afta di couple comeback to South Africa from France afta Siya end im contract wit Racing 92 to join di Sharks.

Tori be say dem separate peacefully and dem go still joinbodi to train and care for dia four children.

Dem go also kontinu to work togeda on dia foundation wey dem set up.


According to di statement from di couple: "We want to share some important tori wit una. Afta plenti tinking and open tok-tok, we don peacefully decide to end our marriage.

"While our relationship as a couple dey change, we go still be great friends and committed partners to raise our children with di same love and care wey dem don always know.

"We go also kontinu to work togeda on di Foundation wey mean so much to us. And we dey grateful for di love, understanding, and support una don show us.

"We kindly ask for una respect as we pass thru dis change."

Siya na South African professional rugby union player wey be di current captain. Im dey play for Sharks United Rugby Championship.

Na former Stormers and Racing 92 player. Im become di first black man to Captain di South African Rugby team afta dem appoint am as captain of di Springboks for 2018.

Im bin lead South African Rugby team to victory for di 2019 Rugby World Cup Final against England. Siya record anoda remarking feat wen im lead dem again to di 2023 Rugby World Cup Final against New Zealand.

For December 2019, Kolisi enta di list of New African magazine 100 Most Influential Africans.

For April 2023, di South African goment honour am nationally as dem give am National Order of Ikhamanga for im contributions to rugby.

For October 2023, Siya Kolisi bin captain South Africa to dia historic fourth Rugby World Cup for Paris, France.

Im also become only di second captain to win di title back-to-back.

Kolisi na one of 44 players wey don win di Rugby World Cup plenti times and im be one of di 25 South Africans wey don also win am plenti times.