You are here: HomeAfricaBBC2024 09 05Article 1949305

BBC Pidgin of Thursday, 5 September 2024

Source: BBC

How military track, arrest suspected killer of FUNAAB student Christiana

Christiana Idowu Christiana Idowu

Police don make arrest over di kidnap and murder of one undergraduate for Lagos, Nigeria commercial city.

Di victim na Christiana Idowu - 21-year-old undergraduate of Federal University of Agriculture, Abeokuta FUNAAB, Ogun State.

Di suspect wey police don identify allegedly collect ransom from di parents of Idowu Christianah.

Police tok tok pesin for Lagos Benjamin Hundeyin tell BBC News Pidgin say na Nigeria Army carry out di operation and dem go soon hand over di suspect to police for prosecution.

Tori bin comot for August say Christianah dey miss and all efforts to find am neva yield any results.

Christianah bin dey go Unilag from Itaoluwa through Yaba on di day she disappear.

As di tori begin trend more details begin come out. Students Union goment of her school release notice say pipo wey kidnap dia colleague don stop to dey pick calls. Dem call for prayers from fellow students to ensure her release.

One girl wey say she be cousin to Christianah post online say she hear say her cousin don die. She add say she remember wen di victim mother die nine years ago wen di girl still dey 12 years old.

Family sources tell BBC News Pidgin say di suspect Ayomide kidnap Christianah and reach out to her parents for ransom of three million naira ($18,000) wey her parents negotiate wit am and dem agree to pay 350,000 Naira.

Tori be say dem pay di money to the account of di suspect, but afta di transaction, di suspect stop to dey pick dia calls.

Security operatives use di account number wey di family use make di payment trace di BVN of di suspect. Dem get im two numbers. Dem use di numbers track him to im parents house for Ikorodu area of Lagos.

Wen dem arrest am, dem find di victim phone on am and also find details of di money transation wey relate to di kidnapping incident.

E allegedly confess to di father of di girl and security pipo say im kill di victim and bury her for shallow grave inside im compound.

Anoda tori wey dey fly upandan be say di suspect bin don get similar murder cases in di past. One tori be say e allegedly kill im girlfriend for 2018 and also kill im blood sister for 2020. Dese reports dey unconfirmed.

Further investigation reveal say di victim and di suspect na friends, dem dey attend di same church and be friends for social media.

Adeleye Ayomide na student for OOU, e dey study Philosophy 200 level.

Lagos State Police Command tok say dem don detain di 23-year-old, Ayomide Adeleye wey allegedly kill 21-year-old, Christiana Idowu and burry her body

Police tok-tok pesin, Benajmin Hundeyin tok say di Nigeria Army hand ova di suspect to police to conduct dia investigation on di mata.

"Di 9 Brigade Nigerian Army don handover 23-year-old Ayomide Adeleye to police. Di handover take place today, September 5, 2024, at about 1400hrs. Investigation dey ongoing," e tok.

Police bin make arrest over di kidnap and murder of one undergraduate for Lagos, Nigeria commercial city.

Di victim na Christiana Idowu 21-year-old undergraduate of Federal University of Agriculture, Abeokuta (Funaab), Ogun State.

Di suspect wey police don identify allegedly collect ransom from di parents of Idowu Christianah.

Police tok tok pesin for Lagos Benjamin Hundeyin tell BBC News Pidgin say na Nigeria Army carry out di operation and dem go soon hand over di suspect to police for prosecution.

Tori bin comot for August say Christianah dey miss and all efforts to find am neva yield any results.

Christianah bin dey go Unilag from Itaoluwa through Yaba on di day she disappear.

As di tori begin trend more details begin come out. Students Union goment of her school release notice say pipo wey kidnap dia colleague don stop to dey pick calls. Dem call for prayers from fellow students to ensure her release.

One girl wey say she be cousin to Christiana post online say she hear say her cousin don die. She add say she remember wen di victim mother die nine years ago wen di girl still dey 12 years old.

Family sources tell BBC News Pidgin say di suspect kidnap Christianah and reach out to her parents for ransom of three million naira ($18,000) wey her parents negotiate wit am and dem agree to pay 350,000 Naira.