Nigeria Presidency don to react to di order wey United States Court for di District of Columbia bin give Federal Bureau of Investigation (FBI) and Drug Enforcement Administration on President Bola Tinubu.
On Tuesday 8 April, di court order FBI and DEA to release records of dia investigations of President Tinubu involvement in alleged drug trafficking.
On top im X page on Sunday, di president tok-tok pesin Bayo Onanuga say notin new dey to dey revealed by FBI and DEA.
"Journalists don seek di Presidency reaction to di ruling last Tuesday by a Washington DC judge wey order di US FBI and DEA to release reports connected with President Bola Ahmed Tinubu.
"Our response dey as follows.
"Notin dey new to dey revealed. Di report by Agent Moss of di FBI and di DEA report don dey for public space for more dan 30 years. Di reports no indict di Nigerian leader. The lawyers dey examine di ruling," Onanuga write for X.
Wetin dey for di court ruling?
For di ruling wey di court upload for dia site, di district judge, Beryl Howell, order say di FBI and DEA "gatz search for and process non-exempt records responsive to di FOIA (Freedom of Information Act) requests wey one American citizen Aaron Greespan bin direct to dem.
According to di court, di evasive "Glomar responses" previously issued in response to di FOIA requests on di matter gatz dey lifted. Glomar responses dey dey given by goment agencies to neither confam nor deny di existence of a particular information requested.
For 2022 and 2023, Greenspan wey be di founder of PlainSite bin seek investigative records about Tinubu, Lee Andrew Edwards, Mueez Adegboyega Akande, and Abiodun Agbele wey bin allegedly dey associated wit one drug ring.
Greenspan bin file 12 FOIA requests wit six different US federal goment agencies including di FBI and di DEA to request di criminal investigation information of di Chicago heroin ring wey bin operated for di early 1990s.
Oda agencies wey Greenspan write to na di United States Department of State, Central Intelligence Agency (CIA), Internal Revenue Service (IRS), and Executive Office of United States Attorneys (EOUSA).
According to di court document, five of di agencies issued Glomar responses to Greenspan FOIA requests. Di agencies tok say dem fit neither nor confam di requested records.
Greenspan den file a lawsuit to challenge di agencies response to di FOIA requests.
For im Tuesday judgement, Judge Beryl A. Howell rule say di Glomar responses wey di FBI and DEA issue no dey proper and gatz dey lifted.
"Defendants dey correct say di principle dey "well established say 'individuals get obvious privacy interest cognizable under Exemption 7(C) in keeping secret di fact say dem be subjects of one law enforcement investigation," di judge tok.
Di judge also tok say di two agencies fail to provide evidence on di burden to sustain dia Glomar responses.
"Di FBI and DEA don both officially confam investigations of Tinubu wey relate to di drug trafficking ring - any privacy interests implicated by di FOIA requests to di FBI and DEA for records about Tinubu dey overcome by di public interest in release of such information. Di CIA don officially acknowledge records responsive to plaintiff's FOIA request about Tinubu," di judge tok.
Wetin be Glomar response?
Agencies dey use Glomar response to refuse to deny or confam di existence of records wey pesin dey request for under Freedom of Information Act (FOIA).
Glomar response no statutory backing, rather di Central Intelligence Agency (CIA) bin create dis form of FOIA determination itself in di case of Phillippi v. CIA wia di CIA bin refuse to confam or deny dia ties to a submarine retrieval ship wey dem dey call "Glomar Explorer.".
Dem dey call di response judicially created response and courts don find say make dem only use am for rare circumstances wia confirming or denying di existence of records fit dey reasonably suspected to cause "cognizable harm" under a FOIA exemption.