You are here: HomeAfricaBBC2024 06 24Article 1937222

BBC Pidgin of Monday, 24 June 2024

Source: BBC

How shark kill Pirates of the Caribbean actor

Pirates of di Caribbean actor Tamayo Perry don die afta shark attack am Pirates of di Caribbean actor Tamayo Perry don die afta shark attack am

Pirates of di Caribbean actor Tamayo Perry don die afta shark attack am.

Im die wen a shark attack am for Hawaii wia e dey surf ontop water wave.

Hawaii na one an island state for di US wia Perry dey always go to go do sport.

Dem first call emergency services to Malaekahana Beach at around 13:00 local time on Sunday.

Na on Sunday afternoon di 49-year-old bin die afta Honolulu emergency services confam am for press conference.

Perry wey dey on lifeguard, dey pronounced dead by paramedics afta dem bring am come wia e land by jet ski.

Acting Honolulu Ocean Safety chief Kurt Lager say Perry na "lifeguard loved by all".

Lager add say Perry na very well known pesin for Oahu north shore as well as around di world.

"Tamayo personality dey infectious, and as much as pipo love am, e love everyone else more."

Di safety chief add: "Our condolences go out to Tamayo family."

Mayor Rick Blangiardi Perry death na "a tragic loss".

Wen im dey address di press conference, Mayor say: "Tamayo na a legendary waterman and highly respected wey grow up right ova here, and just a great member of our ocean safety team."

Mayor Rick say to get dat kain call on Sunday say Perry don die dey very hard to imagine and pipo gatz give di family privacy to mourn di late actor.


Who Tamayo Perry be and role for Pirates of di Caribbean?

Perry play di role of one of di buccaneers in Pirates of di Caribbean: On Stranger Tides, di fourth film for di franchise.

Pirates of di Caribbean na 2011 film, wey follow as Johnny Depp act as eccentric pirate Captain Jack Sparrow, stars like Penelope Cruz and Geoffrey Rush also act for di movie.

Perry don also act for Lost, Hawaii Five-0, Blue Crush and Charlie Angels sequel Full Throttle, and bin appear for one Coca-Cola advert.

Born on di east side of Oahu, Perry don dey surf professionally for ova a decade.

Perry na instructor for di Oahu Surfing Experience, wia im describe im experience as in surfing as "di world deadliest wave".

"Dis small time island boy fit bang am out wit di world best," e write.

E add say several years ago, im dey involved in "a freak accident wey turn into a near-fatal experience".

Perry no elaborate on wetin di incident wey happun bin involve, but say e happun sake of anoda pesin "lack of awareness".