You are here: HomeAfricaBBC2024 06 02Article 1933798

BBC Pidgin of Sunday, 2 June 2024

Source: BBC

How to prevent ‘text neck’ while using your phone and oda tech devices

Bending di head to use phone for long time dey cause neck and back pain for plenti pipo Bending di head to use phone for long time dey cause neck and back pain for plenti pipo

Wetin dey cause you headache, neck and shoulder pain or say pesin no fit to breathe well, fit be many tins.

But as e dey so, sabi pipo dey find say many of dis wahala na as a result of say pesin bend dia head dey look on top dia phone, computer or laptop for long time.

Dis na situation oyibo now dey describe as ‘text neck’.

Every pesin get heavy head wey di neck muscles dey support to hold am upright.

But as you bend di head down as you dey work on computer, laptop or mobile phone, di neck muscles dey strain well-well.

Dis dey lead to sore for your neck wey be very painful wey im fit to lead to posture problems also.

Pipo wey dey spend more time for dia devices get higher chance to experience severe neck pain, sabi pipo don tok.

‘Text neck’ fit to lead to big problem if not treated

One sabi pesin wey be myoskeletal therapist for spine health and wellness center for Accra, Kafui Bagidah tok say if dem no treat di text neck wahala early, e fit to develop to oda tins.

Im tok say, “pesin fit suffer stiff neck, wey dey cause difficulty in moving di neck.”

Anoda tin na say, “di pain fit to move from from di shoulders to di arms wey fit cause pesin im muscles to dey weak.”

As for headache, na very common symptom wit constant migraine.

Text neck wey dem no treat dey also “lead to early onset of spondylosis, disc compression and decrease in lung activity.”

For di last few years, Oga Kafui dey treat patients wey some of dem bin tink say na spiritual problem.

Dem no dey connect wetin dem dey suffer to di way dem dey use dia phone and oda tech gadgets.

Sometimes, dis pipo dey come di hospital afta dem go oda places wey dem abuse painkillers but dem neva dey feel better.

One of dem na 28-year-old Patrick Annor.

Im dey suffer severe neck and spine wahala for two years.

“At some point, I neva fit to turn my head sideways, di tin don dey pain me well well,” Patrick tell BBC Pidgin.

Na afta di tin make serious wey im take go hospital wey dem connect di problem to im sitting posture for work and di long hours im dey spend on top phone and laptop, as IT pesin.

“I don undergo therapy for twelve weeks in 2023 before I begin to dey feel better,” Patrick add.

Im dey visit di chiropractor regularly dat year before im begin to dey see improvement.

Patrick na just one pesin, many odas dey face similar wahala.

Pipo wey be corporate workers, bankers, journalists, IT pipo, hairdressers and tailors na some of di pipo wey don dey suffer dis problem.

How you fit prevent/deal wit ‘text neck’

First tin na say make you adjust di way you dey use phone and oda tech gadgets.

Instead say you go bend your head to dey press phone or laptop, Oga Kafui Bagidah tok say make pipo keep dia devices for dia eye level.

Keeping di devices for eye level as you dey use dem go prevent di situation wia strain go dey on top di neck.

Also from time to time, pipo need to take ‘screen breaks’.

Dis na di situation wia you go reduce di time you spend on your devices in di bad posture.

Anoda tin you fit do na to practise regular neck movement, wey you fit massage di neck and di head for relief.

For di pain to go down, you also fit to use heat and ice packs on top di neck.

If all dis no help, na so you for consult your doctor or therapist.

Phones and oda tech devices don dey make our life easy, but at di same time dem dey cause plenti wahala.

Pesin for now decide how much time dem go spend on dia gadgets and di right posture dem need to use.