BBC Pidgin of Tuesday, 7 January 2025

Source: BBC

'I no expect dis year to begin like dis' - How two pipo die for Rivers gas explosion

Rivers State Ministry of Physical Planning and Urban Development don seal off di area wia di inciden Rivers State Ministry of Physical Planning and Urban Development don seal off di area wia di inciden

One adult and one small pikin one die for di gas explosion wey happun for Oroazi area of Obio Akpor local goment area of Rivers State, southern Nigeria.

Chief Medical Director of di Rivers State University Teaching Hospital (RSUTH), Prof. Chizindu Alikor confam dis one wen Commissioner of Police Rivers State, CP Gbenga Adepoju go visit dem.

Dis two na part of di 16 victims of di gas explosion wey dem rush go di Burns and Plastic surgery Unit for RSUTH for treatment.

Na on Saturday 5 January 2025 di tragic incident happun wen one welder wey dey sell gas cylinders dey work on one of di cylinders.

One eyewitness tell BBC Pidgin say di man wey dey sell gas bin dey weld one cylinder wey dey leak to repair am wen di spark from di welding go reach oda cylinders wey contain gas and di explosion happun.

E say residents for di area bin don complain many times against di dangerous practice but di man continue to carry out im welding activities inside di same shop wey di gas cylinders dey

"As im dey carry out im welding work as usual, unknown to am, one gas cylinder bin dey leak and e kon catch fire for di shop. Dis result to heavy explosion wey shake di entire area," e tok.

Tori be say a moving car wey bin dey pass di street wen di incident happun wit evribodi inside also dey burnt.

'I no expect dis year to begin like dis'

“I no expect dis year to begin like dis!" Na so one business owner wey dey affected for di area take react to wetin happun as dem return from di burial of anoda victim wey dem bury for Port Harcourt cemetery.

Di business owner wey no want mention im name say di girl bin sidon outside dia shop wey dey directly opposite di place wia di explosion happun but di force of di explosion hit her and she suffer serious burn all over her bodi.

"She die yesterday and we don go bury her today for Port Harcourt cemetery, na wetin I fit tok."

Oda victims of di gas explosion dey receive treatment for RSUTH, Military Hospital and one private hospital.

Meanwhile, Rivers State Goment don seal di area wia di incident happun while di Obio Akpor local goment council ban di sale of gas cylinder within residential areas as dem dey review how such activities go go on so as to avoid such incidents for future.