BBC Pidgin of Tuesday, 25 March 2025

Source: BBC

International student applications wey drop after UK impose visa restrictions dey affect universities

Raha Fazlollahei, from Iran, dey study creative writing for di University of Lincoln Raha Fazlollahei, from Iran, dey study creative writing for di University of Lincoln

Di University of Lincoln don join oda universities across di UK wey dey call on government to reconsider di decision to impose visa restrictions on international students.

UK goment bin introduce di restrictions wey stop some students from coming wit dia families come di kontri for di beginning of 2024.

Di goment say di new rules na part of measures to control immigration.

Di university tok say dem don see 51% drop in allocations from international students since di changes start.

One student Raha Fazlollahei, from Iran, say e dey "really heart-breaking" to dey so far away from her family, but also, na opportunity to dey independent.

She say: "E help me grow to dey independent and I really like am. I be 22 right now and at dis age I fit dey on my own."

E dey cost her more dan £30,000 every year to study creative writing for UK, but she say di money worth am to build her dream life.

Di university, like most odas, tok say na di international student fee income dem bin dey rely on to compensate for di freeze on home tuition fees.

Dem tok say international student applications bin fall from 2,995 for 2023-24 to 1,460 for 2024-25.

Nationally, Home Office figures show say dem grant 393,125 visas for 2024, wey represent 14% drop on di figures from 2023, but e still dey 46% higher pass wetin e be for 2019.

"Removal of di dependents visa don make UK less attractive study destination overall for competitive global marketplace for student recruitment, particularly for international masters students," di university tok.

"We support sector calls for a more evidence-based approach to international students in national immigration policy, wey recognise di need to manage true migration for way, wey e no go affect economic and societal benefits of di UK standing as a global study destination."

Godswill James, from Nigeria, dey study IT and e say although changes "dey impact", oda contributing factors like initial course fee deposits and di cost dey bite.

E dey cost am between £25,000 and £30,000.

Fellow student Sibghatullah Karimi, from Afghanistan, believe say those figures represent "big challenge" to some kontris.

E say: "Students from Asian and African kontris, dia currency difference too high, so if we convert dat current, e go be in millions."

Tsuy Tuong, from Hanoi, Vietnam, say she bin dream of studying in England since she dey 15 and she bin fall in love wit di British culture.

She bin tink say to dey on her own without family na good and bad thing.

Local economy impact

Apart from say dem dey grow di university income, international students also dey important to di local economy, according to Michael Stacey, wey be di general manager of Craft bar, wey dey attract plenty students.

E say: "Dem get massive economic benefit plus massive social benefit. Dem dey improve everything.

"I think immigration na wetin make our kontri fantastic. Multiculturalism dey bring something different and I think if we tone am down and dey our lane alone, we no go ever broaden our horizons, we no go ever learn anything new."

E dey estimated say one in seven pesins for di university na international students.

BBC don reach out to di goment for comment, but di goment bin tok bifor say international students "go always dey welcomed but di net migration levels wey we see in recent years bin dey completely unacceptable, and we dey committed to reducing those numbers substantially".