Israel and Hamas don agree to a new Gaza ceasefire and hostage deal afta 15 months of devastating war.
One source wey dey aware of di discussion tell di BBC.
Di Israeli goment or Hamas neva tok anytin but one Hamas official also tell BBC say, di group don approve one draft from US, Qatari and Egyptian mediators.
Details of di three-phase plan neva dey published, but tori be say, during di first six weeks of di ceasefire, dem go exchange 33 of di hostages wey still dey Hamas captivity for Palestinian prisoners for Israeli jails at regular intervals.
Israeli forces go pull back from populated areas of Gaza and dem go allow displaced Palestinians to begin return to dia homes.
Negotiations for di second phase – wey go monitor di release of di remaining hostages, full withdrawal of Israeli troop and a "sustainable calm" - go start afta two weeks.
Di third and final stage go involve di reconstruction of Gaza - something wey fit take years – plus di return of any remaining hostages' bodies.
Di Israeli military bin launch one campaign to destroy Hamas afta di group carry out attack on southern Israel on 7 October 2023, wey lead to di death of 1,200 pipo and dem take 251 pipo hostage.
More dan 46,700 don die for Gaza since then, according to di territory Hamas-run health ministry.
Most of di 2.3 million population also don scata, widespread destruction, severe shortages of food, fuel, medicine and shelter dey for Gaza sake of struggle to get aid to those wey need am.
Israel say 94 of di hostages still dey Hamas capacity, and dem reason say 34 of di hostages fit don die. In addition, four Israelis bin dey kidnapped bifor di war, two of dem don die.