Anoda attack don kpai plenty pipo for Bassa local goment area of Plateau State, according to wetin residents tell BBC Pidgin.
Dis fresh attack happen for di early hours of Monday, between one and two am.
Yakubu Ventim who be tori pesin for di state tok say di chairman of Bassa local goment area, Joshua Sunday Riti, bin carry some TV tori pipo wit plenty security to di community wia di attack bin happen.
"Na about 38 to 50 pipo dey massacred for di village dis morning," oga Ventim took.
"Dem ambush di community and kill mostly women and children."
"Security don dey drafted to di area but we no know how things be now. Di security pipo neva address tori pipo about dis particular attack."
Channels TV also report di attack wia dem tok say na 36 pipo bin die afta di jaguda pipo shoot dem, but anoda four later die for hospital to make am a total of 40 pipo wey kpai for di attack.
Wakili Tongwe, wey be community leader and also one of di vigilante pipo who bin dey on duty wen di attackers come na im confirm di attack.
BBC Pidgin call di police tok-tok pesin for Plateau State, Alfred Alabo to get details but e no answer im call and e never respond to message wey we send to am.
About two weeks ago, 52 pipo bin kpai for inside anoda attack for Bokkos local goment area of di same Plateau State.
Di development make di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu to visit di area wia e promise say enough don dey enough for di killers, and e go make sure say di killings stop.
Ova di years, crisis betwin herders and farmers na regular tin for many parts of northern Nigeria including Plateau and Benue States.
But recently, di Govnor of Plateau State, Caleb Mutfwang, tok say dis regular attacks wey dey happen for di State don pass herdsmen and farmers fight but wetin dey happen now na terrorist attacks and "genocide".
Mutfwang tok dis one for one interview wit tori pipo as e lament say di killings don too much despite all di efforts wey di state goment dey do to make sure say peace dey.
"I dey tell you for all honesty say I not fit find any explanation wey pass say dis na genocide wey terrorists dey sponsor. Di question na who be di pipo wey dey behind di organisers of dis terrorism? Dis na wetin di security agencies must to help us to unravel," di govnor tok
"As I dey talk to you, e no dey less dan 64 communities wey don dey taken over by bandits for Plateau between Bokkos, Barkin Ladi, and Riyom local govments. Dem don take di communities over, rename dem, and pipo dey live dia comfortably on top lands wey dem pursued pipo comot and occupy."
In December 2023, jaguda pipo kpai more dan 115 pipo and displace 64 communities for Bokkos and Barkin-Ladi local goment areas of Plateau State.