You are here: HomeAfricaBBC2023 04 17Article 1750454

BBC Pidgin of Monday, 17 April 2023

Source: BBC

Kasala don spread for Sudan as explosions dey rock di capital

File photo File photo

Na so so reports of fierce clashes across Sudan as fighting between rival armed factions continue to dey spread.

Violence between di army and one paramilitary group wey dem call di Rapid Support Forces (RSF) continue overnight into im third day.

Nearly 100 pipo don die for clash, according to wetin one doctors' union tok, and one estimate put di number of pipo wey dey injured at 1,100.

Both sides dey claim to have control of key sites for di capital Khartoum, wia residents dey hide from explosions.

Earlier on Sunday, dem hold a temporary ceasefire to allow di pipo wey injure bcomot, although e no dey clear how strictly dem stick to am.

Doctors drwa ears say di situation for hospitals inside Khartoum dey extremely difficult, and say di kasala dey stop both staff and medical supplies from reaching pipo wey get injuries.

Di kasala na part of one vicious power struggle within di kontri military leadership, wey dey escalate enta violence between rival factions.

Di two men for im centre disagree over how di kontri suppose transition to civilian rule. Generals dem don dey run Sudan since one coup overthrow di long-standing authoritarian president, Omar al-Bashir, for 2019.