Kamala Harris and Donald Trump dey exchange insults as di race for di White House don dey hot well-well.
For one TV event on Wednesday, Harris say she beliv say her opponent na "fascist", (dictator) she tok say Trump wants "unchecked power"
Meanwhile, Trump no keep quiet as im respond to her, im say Harris get "warped mind" and she be "threat to democracy"
E no end for dia, Harris kontinu to attack for di final fortnight - BBC North America correspondent Anthony Zurcher torchlight di strategy.
Wit less dan two weeks to go until polling day on 5 November, polls suggest say di race fit tight well- well for di battleground states
Elsewia, di Justice Department don send letter to Elon Musk campaign group America PAC to warn say dia $1m giveaway fit dey illegal.
Still on di election campaign mata, Barack Obama go showface alongside Kamala Harris for one rally for Clarkston, Georgia, Thursday afternoon.
While Donald Trump go dey for Arizona State University Mullet Arena on Thursday.
Im go later go Las Vegas wia im go speaking for one rally wey Turning Point - a conservative group wey dey advocating for conservative politics for education dey hold.
Early voting go kontinu as over 26 million pipo across di US don already vote, according to di University of Florida Election Lab early voter tracker.
Wia Harris and Trump stand on di big issues?
As election dey come closer, and presidential candidates dey tryb to conclude dia campaigns for dia final try to win over voters wey neva decide who dem go vote for.
Mkae we chook eye inside some of dia policies and some of di most pressing issues.
Inflation: Harris say her day-one priority na to try to reduce food and housing costs for working families.
Trump promises to "end inflation" and say deporting undocumented immigrants go ease pressure on housing
Abortion: Harris dey advocate for legislation wey go protect reproductive rights nationwide.
Trump - wey wen im bin dey office make way to overturn di constitutional right to abortion, one 1973 ruling known as Roe v Wade - dey struggle to find a consistent message on abortion
Immigration: Harris still stand her ground as her experience as a prosecutor for California wey dey take on human traffickers.
Trump vows to close di border, im say im go complete di construction of a wall and increase enforcement
Guns: Harris pledge to prevent gun violence and she dey advocate for tighter laws. Trump don position imsef as a staunch defender of di Second Amendment, di constitutional right to bear arms.
Plenty tok-tok dey happun especially about di seven swing states wey dey expected to determine di outcome of di election
Di seven key battleground states na Arizona, Georgia, Michigan, Nevada, North Carolina, Pennsylvania and Wisconsin.
https://cdn.ghanaweb.com/imagelib/pics/491/49108162.jpg