BBC Pidgin of Monday, 28 October 2024

Source: BBC

Lawmaker alleged assault of Bolt driver: Wetin be di global delivery practices?

Alex Ikwechegh, a House of representative member Alex Ikwechegh, a House of representative member

On Sunday, Bolt driver, Stephen Abuwatseya allege say Oga Alex Ikwechegh, a House of representative member assault am and tear im cloth wen e go deliver package to am for im house in Abuja.

Inside one video wey dey spread for social media, di bolt driver request for im money but di lawmaker refuse say im no go pay di driver becos of disrespect.

Oga Ikwechegh insist say e no go pay di driver, and as im dey express im anger e call di business owner to report di delivery man while making threatens say e go "make dis man disappear in di whole Nigeria and notin go happun."

Di lawmaker and driver begin exchange words ova di matta and di lawmaker waka towards di driver, wit sound of phisical attack.

Oga Abuwatseya allege say di lawmaker slap am three times for di video " Are you slapping me sir?"

"You dey look me and tink say you fit beat me? Who do hell you tink you dey follow tok. You sabi who I be?"

Inside di second video, di driver allege say di lawmaker tear im cloth comot from im body "As una dey see I no wear cloth, e don tear my cloth e slap me three times........"

Di lawmaker threaten am make im go report to di police "Call di Inspector General of Police. Call am, make im come here. Record me very well. You come my house, you disrespect me."

Di driver respond say im no disrespect am, make di lawmaker pay am im money so go fit comot.

Di lawmaker neva tok anytin on di mata since di video come out.

Meanwhile, di Nigeria Police don react to di video, say dem go launch investigation into di alleged assault wey happun between Bolt driver, Stephen Abuwatseya, and Alexander Ikwechegh, for Maitama, Abuja.

Police authorities for Abuja police command say dem dey handle di matta actively afta Abuwatsey make official report for Maitama Divisional Headquarters.

"Di Police Force also beg di public make dem stop to dey use di name or office of di Inspector-General of Police to intimidate odas, as such actions undermine di values of impartiality wey di IGP office uphold."

Netizens condemn Nigeria lawmaker, Alex Ikwechegh for allegedly assaulting di Bolt driver wey come deliver items for im house, pipo claim say e dey abuse im position as politician but really wetin be di global delivery practices.

Who be Alex Ikwechegh

Alex Ikwechegh begin im poltical career for 2019 as chairman for Aba North local goment in Abia state at di age of 28. Im kontinu as im seek election as representative for di North and South Federal Constituency.

E hold bachelor degree from University of Calabar wia e graduate wit degree in business management.