BBC Pidgin of Thursday, 3 April 2025

Source: BBC

List of countries Trump reciprocal tariffs affect for Africa and around di world

US President Donald Trump announce one ogbonge new set of tariffs US President Donald Trump announce one ogbonge new set of tariffs

US President Donald Trump announce one ogbonge new set of tariffs on Wednesday, arguing say e go allow di United States to economically flourish.

Dis new import taxes, wey Trump impose via executive order, dey expected to send economic shockwaves around di world.

But di US president believe say dem dey necessary to address trading imbalances and to protect American jobs and manufacturing.

Dis na di basic elements of di plan.

African countries wey dey affected

Lesotho - 50%

Madagascar - 47%

Mauritius - 40%

Botswana - 37%

South Africa 30%

Nigeria - 14%

Kenya - 10%

Ghana - 10%

Ethiopia - 10%

Tanzania - 10%

Uganda - 10%

Senegal - 10%

Liberia - 10%

Countries wey go face a 10% baseline tariff

Inside one background call before Trump speech, one senior White House official tell reporters say di president go impose a "baseline" tariff on all imports to di US.

Dat rate dey set at 10% and go go into effect on 5 April.

Na di companies wey dey bring di foreign goods into US naim get to pay di tax to di government, although dis fit get knock-on effects to consumers.

Some countries go only face di base rate. Dem include:

.United Kingdom

.Singapore

.Brazil

.Australia

.New Zealand

.Turkey

.Colombia

.Argentina

.El Salvador

.United Arab Emirates

.Saudi Arabia

Countries wey go get a custom tariff for 'worst offenders'

White House officials also say dem go impose wetin dem describe as specific reciprocal tariffs on roughly 60 of di "worst offenders".

Dis go go into effect on 9 April.

Trump officials say dis countries dey charge higher tariffs on US goods, impose "non-tariff" barriers to US trade or don otherwise act in ways dem feel say go undermine American economic goals.

Di key trading partners subject to dis customised tariff rates include:

European Union: 20%

.China: 54%

.Vietnam: 46%

Thailand: 36%

.Japan: 24%

.Cambodia: 49%

.South Africa: 30%

.Taiwan: 32%

No additional tariffs on Canada and Mexico

Di 10% baseline rate no apply to Canada and Mexico, since dem don already dey targeted during Trump presidency.

White House say e deal wit both countries using a framework set out for Trump previous executive orders, wey impose tariffs on both countries as part of di administration efforts to address di entry of fentanyl to di US and border issues.

Trump previously set those tariffs at 25% on all goods entering from both countries, before announcing some exemptions and delays.

25% tariffs on car imports

In addition, di president confirm di beginning of a new American "25% tariff on all foreign made-automobiles".

Dis tariff go into effect almost immediately, at midnight local time.