BBC Pidgin of Tuesday, 1 October 2024

Source: BBC

Main reason why Lawmakers activate impeachment of di Deputy president of Kenya

Rigathi Gachagua, deputy president of Kenya Rigathi Gachagua, deputy president of Kenya

Legislators for Kenya don start di process of removing di kontri deputy president from office.

Dem accuse Rigathi Gachagua say e get hand in di violent protests wey happun for Kenya three months ago.

Dem also claim say Gachahua allegedly dey involved in corruption, undermining goment and promoting ethnically divisive politics.

Ruto bin choose Gachagua as im running-mate for di 2022 election, wen e defeat former Prime Minister Raila Odinga inside one bitterly contested election.

Gachagua come from Mount Kenya region wia votes dey high, and e help oga Ruto gada support for dia.

But as members of Odinga party don join di goment afta one protest wey youth organise, wey force Oga Ruto to stop di subsidy on tax increment, di political dynamics for di kontri don change – dem begin sideline di deputy president.

Legislators say dem dey prepare to table one motion for parliament, as dem call for impeachment proceedings to dey instituted against am.

“I don already add my signature to am,” majority leader Kimani Ichung’wah tok.

Allies of di deputy president don launch several attempts for di High Court to stop di motion, make legislators no table am, but e fail.

Several legislators bin tell local media say dem don pass one-third of di threshold, and about 250 lawmakers don already support di move to table di motion for debate.

“I bin dey surprise say I dey for number 242 to sign am and queue [still dey wait to sign],” legislator Didmus Barasa tok.

“Na settled mata, di DP [deputy president] ask for am,” anoda legislator, Rahim Dawood add.

Gachagua however no gree as e say im get di backing of voters for im native central Kenya region.

“Two-hundred pipo no fit overturn di will of di pipo,” e tok.

For di motion to pass, e go need di support of at least two-thirds of di members of di National Assembly and Senate, nominated members no dey among.

Pipo wey dey back di motion dey confident say e go happun, especially as dem now fit also rely on di votes for Odinga party.

But Gachagua don make am clear say im no go go down without a fight.

“Di president fit ask MPs to stop. So, if e kontinu, e dey involve,” e tell tori pipo for im political base, Mount Kenya.

Ruto bifor now bin don promise say im no go subject Gachagua to “political persecution”, like wetin e experience wen e be deputy to im predecessor, Uhuru Kenyatta.

But di fight between Ruto and Gachagua in recent months don dey clear for public.

E dey very noticeable as pipo no dey see di deputy president follow in boss go airport again wen e travel abroad or dey receige am wen e return.

E be like say na di Interior Secretary Kithure Kindiki, one law professor wey di president trust dey carry out some di deputy president responsibilities - something wey bin also happun wen Ruto and Kenyatta fall out.

Like Gachagua, Kindiki come from Mount Kenya - di region wey form di largest voting block for Kenya.

Dozens of legislators don rally d behind Kindiki as di region prefer “mouthpiece", wey intensify di rumour wey dey spread say dem dey push for am to replace Gachagua.

Dis don make di deputy president remove imsef and join bodi wit di small politicians wey dey support am.

If di deputy go, di president must go too - Kenya youth

Anoda sign wey make am clear say e dey for political trouble na say di police Directorate of Criminal Investigations (DCI) bin recently recommend charges against two MPs, one staff member plus oda close allies of di deputy president, afta dem accuse dem of “planning, mobilising and financing violent protests” wey happun for June.

Gachagua bin defend di accuse. E reject di charges as e say na "act of aggression" and “evil scheme” to “soil” im name and lay di groundwork for im impeachment.

For parliament last week, Kindiki – pesin wey di DCI fall under im ministry – bin promise to remain neutral, but make am clear say “high-level individuals” go dey prosecuted.

"We dey deal wit di aftermath of di attempted overthrow of di constitution of Kenya by criminal and dangerous pipo wey burn di parliament of Kenya. We get job to do," e tok.

But many of di young pipo wey bin dey di forefront of di protests disagree wit di suggestions say na Gachagua allies bin dey behind di protest.

Dem see di mata like say lawmakers dey try remove am as attempt to remove attention from bad governance.

Dem say if di deputy go, di president must go too.

Ruto, wey dey expected to host legislators from im party later dis week, go weigh di political risks of moving against Gachagua, but some lawmakers say dem no wan chook mouth for di debate.

For now, Gachagua fate rest wit di legislators, but one man still fit extend im renewed lease of political life – di president.