BBC Pidgin of Thursday, 4 July 2024

Source: BBC

Millions of voters dey cast dia vote for UK 2024 general election

Polling staff for di Agape Centre for south Belfast make sure voters know wia to go Polling staff for di Agape Centre for south Belfast make sure voters know wia to go

Millions of voters don begin cast dia ballots for UK first July general election since 1945.

Polling stations wey dem set up inside buildings like local schools and community halls, don open between 07:00 and 22:00 BST on Thursday.

Around 46 million voters dey eligible to elect 650 members of Parliament go di House of Commons.

Dem go declare di results for each area, or constituency all through di night and into Friday morning.

Political parties dey hope to win more dan half di seats, 326, in order to form a majority goment.

Key timings and wetin to expect today

Dis na di first time since December 2019 wey di whole kontri go get say on who go sit as Members of Parliament for di House of Commons and which party go form di next goment.

Ballot boxes go opem at 07:00 BST across UK and you go fit cast your voe until 22:00.

Counting of votes go begin immediately.

Meawnhile, Prime Minister Rishi Sunak don vote for North Yorkshire.

Im and im wife Akshata Murty bin turn up for dia polling station, one village hall for Northallerton, about half an hour afta di polls open to cast dia vote.

Photo ID to vote for di election

Dis na di first general election wey voters for England, Wales and Scotland go need show photo ID to vote in pesin.

Na 22 acceptable forms of ID dey, including passports, driving licences, older or Disabled Person's bus passes, and Oyster 60+ cards.

Nine valid forms of ID na im dey to vote for Northern Ireland, wia voters gatz show photo ID since 2003.

Alternatively, pipo wey register to vote wey no get correct ID fit apply for one free document dem call voter authority certificate.

Voters for England, Scotland and Wales wey don lost dia ID or wey jaguda pipo tiff dia ID afta di deadline fit apply for emergency proxy vote, up until 17:00 on polling day, to allow anoda registered voter cast a vote on dia behalf.

Those wey apply for postal vote but neva return am fit hand am ova to dia local polling station by di close of polls at 22.00 BST.

Alternatively, dem fit also hand am ova to dia local council office during office hours.

Wen di results dey expected?

Afta di polls close by 22:00 BST, dem go collect di ballot boxes for di 650 constituencies from di polling stations go counting centres and counting go begin immediately.

Dem go declare di first seats some time close to 23:00 and dem go declare di rest before 09:00 on Friday morning.

Between 02:00 and 04:00 dem go don announce 325 seats and between 04:00 and 06:00 anoda 275. Di last few results go come in later on Friday morning.

E dey hard to say wen we go know if any party don win di election, wit enough MPs elected to form a majority for di House of Commons.

If one party win for 326 constituencies – dat na just ova half di number of seats for di Commons – dem don gain majority.