You are here: HomeAfricaBBC2024 06 12Article 1935316

BBC Pidgin of Wednesday, 12 June 2024

Source: BBC

Minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

President of  Nigeria Bola Tinubu President of Nigeria Bola Tinubu

President Bola Tinubu address Nigerians on June 12 Democracy Day, and for im speech, im touch on some issues facing di kontri pipo.

Di president also use di opportunity to honour di memory of Nigerians wey bin sacrifice to nation building.

President Tinubu also honour di media for dia work during di struggle for democracy.

According to di president, Nigeria gatz continue wit democracy no mata how complicated e fit be.

Highlights of President Tinubu address

Minimum wage

President Tinubu tok say im don negotiate wit organised labour on a new national minimum wage.

E say im administration go soon send executive bill to di National Assembly to stipulate wetin don dey agreed upon as part of of Nigerian law for di next five years or less.

"In di face of labour call for a national strike, we bin no seek to oppress or crack down on di workers as a dictatorial goment go don do. We choose di path of cooperation ova kasala," Tinubu tok.

"Di president tok say im take on "dis vital task witout fear or favour and I commit mysef to dis work until we don build a Nigeria wia no man dey oppressed."

Rights, freedoms, and liberties of Nigerians

President Tinubu tok say as leader of di nation, im vow to do im utmost best to protect di rights, freedoms, and liberties of Nigerian citizens.

"Even more dan dat, I pledge to do whatever dey necessary to cement democracy as our way of life.

"Although di challenges dey steep and multiple, I dey grateful to lead Nigeria at dis moment in her history and point in her democratic journey."

Economy

President Tinubu for im speech tok say im go use di opportunity of Democracy to take defend di economy of Nigeria.

Im add say Nigeria economy no too balance sake of say di past goment don depend ontop oil too much.

"We gatz commit oursef to di realisation of economic democracy."

"I feel your pains but I go continue to refine di economy. Our economy dey unbalanced becos say e dey built on oil exploration."

Pipo wey wan destroy democracy

President Tinubu remind Nigerians say even though democracy fit dey complicated sometimes, na still di best choice for Nigeria.

“As Nigerians, we gatz remind oursef say no mata how complicated democracy dey, na di best form of governance in di long run,” im tok. E add say make di pipo shine dia eyes as e get some pipo wey wan destroy democracy.

E say no be like say dis pipo wan make tins beta o, but dem wan scata democracy so dem go fit control anybody wey no dey for dia gang.