You are here: HomeAfricaBBC2023 09 13Article 1843601

BBC Pidgin of Wednesday, 13 September 2023

Source: BBC

'Mohbad struggle till death' - Singer wife lament say she be widow at 24

Di late Mohbad and im wife Wunmi Di late Mohbad and im wife Wunmi

Di wife of Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad don reveal say di artiste bin dey go through a lot before im death.

Di singer wife simply identified as Wunmi tok dis one for Instagram live as she dey mourn di death of her husband.

She tok say Mohbad bin struggle till death as di artiste get too much pains and threat.

Wunmi tok say her husband bin dey live in fear and e dey engage in fights evri where im go.

According to Wunmi, her husband neva dey happi for a whole day.

“Dem call am junkie, a mad pesin,” she tok.

Di artiste wife also tok say pipo dey call am all dis kain name sake of say dem want di public to get anoda view about her husband.

“E don die now, at least all of you win, make una take una trophy,” she tok.

She lament say dem make am widow at 24 years and ask God to serve im judgement.

Wunmi tok say notin dey make Mohbad happi anymore.

According to Wunmi, even afta di singer see im baby, im become more worried say im don get family and e no want anytin to happun to im baby and im wife.