Tears flow from her eyes as nobodi fit console am sake of say she experience di moment her parents and three younger siblings burn to death for Sokoto State.
Di tragedy wey strike Hauwa'u also strike oda pipo wey lost families to di alleged accidental drone attack by di Nigerian military on Tuesday 25 December.
Report be say di drone attack kill 10 pipo and and injure six odas for Rumtuwa and Gidan Sama for Silame local goment for Sokoto state, northwest Nigeria.
One resident Malam Muhammad wey follow BBC News Pidgin tok say na 7am di incident happun as soldiers enta di two villages.
Muhammad wey dey live near di village wey di incident happun say "later three aircraft wey dem believe say belong to di military come dey drop bomb for di place".
"In di morning between 6am to 7am somtin, soldiers surround di communities for ground, later three aircraft begin dey drop bomb."
Di man still tok say afta di bomb don finish, pipo for Lemi, Gwandawa, and oda nearby villages come out to see wetin happen.
But di man say wen dem try reach di villages, di soldiers no gree make dem enter.
"Na later wen tins begin dey come down we approach di communities to see for our eye wetin happun but military no let us go close," im tok.
According to wetin Muhammad tok, di chairman and di Chief for Silame go di villages to see wetin happun wit dia own eyes.
E still add say dem no fit confam how many pipo die or wound sake of di soldiers still dey for di villages.
E come tok say no evidence dey to show say di attack na Lakurawa dem wan target becos many terrorist dey for di area.
BBC News Pidgin contact di Director of Defence Media Operations, Major General Edward Buba but im no pick call.
Wen BBC contact di tok-tok pesin for Sokoto Police Command, ASP Ahmad Rufa'i, e decline to comment on di mata and add say na di military go comment.