You are here: HomeAfricaBBC2024 09 09Article 1949842

BBC Pidgin of Monday, 9 September 2024

Source: BBC

Nigerian parents lament as fuel price hike drag school fees go up

File photo File photo

Nursery, primary and post primary school students for Nigeria don resume school on Monday, 9 September, afta di long vacation wey start since di ending of July.

But wit di recent increase for di price of fuel, many schools don also increase di school fees and dia prices of school bus services.

For some states like Edo and Kano, di state goments don even postpone school resumption until further notice.

Di Edo State goment say dia reason for di postponement na sake of "di tension wey arise from di recent increase for fuel prices", while di Kano State goment say na sake of "some urgent reasons wey go help to improve di provision of conducive learning atmosphere for our children".

Both State goments no tok di new date wen school go open, but dem just say di date go dey announced.

Last week, di Nigeria goment, thru di Nigeria National Petroleum Company Limited (NNPCL) bin announce di increment of di pump price of petrol per litre from about 617 naira to 897 naira.

Di development quickly shoot up transportation costs for across di kontri, wit pipo lamenting to BBC News Pidgin say dem go dey spend more dan 50% of dia current salaries on transportation alone.

Now wey schools don resume, some schools don inform parents say school fees and moni for oda services such as school bus, don increase.

One pesin wey im name na Prince Dandy tell BBC News Pidgin say "Rivers State don resume ooo. Tinkin wan finish me. Four kids no be beans."

Anoda parent for Abuja ask BBC News Pidgin tori pesin say "how I go dey pay 80,000 for pikin wey dey nursery two?"

According to di parent, Felicita Obi, her child school fees last term na 65,000 but as she take di child to school dis Monday, dem inform her say school fees don change.

"Salary no change oh, but school fees don change, fuel price don change, electricity price don change," she tok

Electricity supply no dey regular for Nigeria, power cuts dey frequent and sometimes di national grid fit collapse kon throw majority of pipo inside blackout for long period of time. So individuals and businesses dey usually rely on generators wey dey use petrol to supply power for dia daily needs.

For a primary school setting for instance, you go need to use generators to take pump water, fans in classrooms, power teachers computers and many oda tins. So increase in fuel price go directly increase di running cost of di schools.

And wit di rising cost of living and di recent increase of minimum wage for goment workers, e no be surprise if teachers for private schools start to dey demand for higher pay.

School bus service dey cancelled
One woman wey give her name simply as Priscilla tell BBC News Pidgin say her children school bin send dem message for dem to start making arrangements for dia children transportation becos di school don stop dia school bus services.

"We bin dey pay 120,000 for our two children wey dey di school. And dis amount na just one-way o, for di school bus to bring dem home becos we dey drop dem off in di morning on our way to work. If na for di bus to take dem to and from school, e go be 120,000 for one child wey mean say we for dey pay 240,000 naira," Priscilla tok.

"But afta di increment, di school tok say dem no go fit to offer di school bus services again, so we dey tink wetin we go do and how to make arrangements for a trusted private taxi pesin wey go dey bring di kids back afta school."

Di first term of di 2024/2025 academic session for Nigeria dey expected to run from dis Monday, September 9, to Friday, 16 December 2025, wen di Christmas holidays go start.