BBC Pidgin of Sunday, 22 December 2024

Source: BBC

Nutritionist explain di health benefits of kunu

Kunu bi Nigeria drink Kunu bi Nigeria drink

Kunu no be just drink; na one piece for Nigeria heritage wey pipo dey consume for almost evriwia for di kontri and oda neighbouring kontris.

Kunu dey sweet and dem dey make am from grains like millet, sorghum, maize, or even rice.

Each type of Kunu get im own flavour, depending on which type of grain you use do am - you fit get milky light-brown colour wit sorghum or get white colour wen you use millet, maize, or rice.

E dey veri simple and na one vital drink wey hold special place for many house for Nigeria.

Millet na di common grain pipo dey take do Kunu while some pipo dey use pearl millet, finger millet, sorghum, wheat, and rice.

Dr Saadatu Sulaiman wey be Higher Nutrition Officer and Dietitian tok say kunu dey play a good role for pipo lives for many part of Nigeria.

Kunu don turn food wey pipo dey enjoy for morning, especially wen dem combine am wit fried snacks like beans cake (akara), moi-moi, or masa.

Dis kain combination of kunu wit delicious local snacks dey veri sweet and na great way pesin fit start im day wit energy.

Health benefit of kunu

Kunu get many health benefits, sake of di grains and oda natural ingredients.

Dr Sulaiman tok say kunu get nutrients like fiber, protein, healthy fat, iron, and folate. E dey help digestion, boost energy, and support immune system. Di fermentation dey add probiotics wey dey good for belle health.

Dis kain nutrients dey support energy production, digestion, immune health, and overall well-being.

Kunu nutritional value dey depend on di grain wey dem use.

- Millet kunu get carbs and fiber for energy and digestion, also get iron, wey dey important for red blood cell production.
- Fonio kunu dey manage sugar levels and give protein wey dey help for bodi function.
- Sorghum kunu get protein, fiber, iron, and magnesium, im protein for bodi pass oda gains.
- Rice kunu dey smooth and sweet wit plenty carbohydrates for energy for bodi.
- Groundnut kunu get healthy fat and extra protein wey good for bodi, good for breakfast.
- Moringa kunu get vitamin A, C, and E and antioxidants wey dey support immune system.

Dr Sa'adatu tok say kunu na beta drink for busy mornings and e dey hydrate especially for pipo wey dey fast.

Nutritional profile of kunu dem make wit millet

Millet; whole grains, raw (per 100g) contain:

- Energy 365 Kcal
- Carbohydrate 64.2g
- Fiber 9.0g
- Protein 9.3g
- Fat 5.9g
- Iron 15.2mg
- Folate 160µg
- Cholesterol 0mg
- Sat Fat 0.96 g
- Mono unsaturated fat 1.10g
- Poly unsaturated fat 2.19g

Nutritional profile of kunu dem make wit Fonio

Fonio; white, raw (per 100g) contain:

- Energy 334 Kcal
- Carbohydrate 59.7g
- Fiber 16.4g
- Protein 7.1g
- Fat 3.8g
- Iron 29.4mg
- Folate 120µg
- Cholesterol 0mg
- Sat Fat 0.59g
- Mono unsaturated fat 0.81g
- Poly unsaturated fat 1.30g

Nutritional profile of kunu dem make wit groundnut

Groundnut, shelled, dried, raw (per 100g) contain:

- Energy 574 Kcal 574
- Carbohydrate 17.4g
- Fiber 8.3g
- Protein 22.4g
- Fat 44.2g
- Iron 3.5 mg
- Folate 110µg
- Cholesterol 0mg
- Sat Fat 8.92g
- Mono unsaturated fat 20.64g
- Poly unsaturated fat 12.72g

Nutritional profile of kunu dem make wit SorghumSorghum whole grains, raw (per 100g) contain:

- Energy 342 Kcal
- Carbohydrate 61.1g
- Fiber 11.9g
- Protein 11.5g
- Fat 3.5g
- Iron 6.8mg
- Folate 64µg
- Cholesterol 0mg
- Sat Fat 0.48g
- Mono unsaturated fat 1.16g
- Poly unsaturated fat 0.86g