Ogbonge Nollywood actress and filmmaker, Omoni Oboli don share di experience of how she take grow for di movie industry.
For dis exclusive interview wit di BBC Pidgin, she tok on how di movie industry for Nigeria don improve ova di years.
Di producer of 'The Uprising: Wives on Strike' na mother and grandmother afta her son give birth, but she still dey show plenti strengths wit beauty for di acting profession.
She don act for movies wey include Figurine, Oloture, Last year single, love is war, Okafor's law, Mother at war, and many odas.
Journey into Nollywood
Omoni Oboli say her journey into Nollywood don tey as she still be teenager wen she begin find acting role, alongside wit her friends.
She narrate how she begin go from one audition to di oda so she go fit find one role to act. For one of her role, she open door for di ogbonge actor Richard Mofe Damijo (RMD) and also do house girl for Liz Benson.
"I bin come Lagos, becos of some of my friends. Dat time I don enta university, some of my friends for school dem say dat dem come Lagos and come enta feem."
For her hustle tori, Omoni Oboli say na Lagos she dye come do audition dat time and if she qualify, na dat time dem go give dem role to act.
"Dat time mobile phones no even dey. You enta bus go di place, wen you reach dia you go join di line do audition. If your name dey shortlist, you go come back come do casting."
Nollywood quality
She move from acting into directing and producing. Dis don place her as one of di big pipo for di Nollywood industry.
Wen we ask her how Nigerian movies dey do in terms of quality, Omoni say ovies for Nigeria don improve well well.
She add say pipo don go school to learn more and equipment don dey and na part of wetin make di quality of movies now dey different from bifor.
"Wen you watch di feems wey dem dey do dat time and di feems wey we dey do now, you go see say di quality don really go up."
"We still get long way to go ooo, no be say we don reach wia we dey go ooo but atleast we don dey try."
'Piracy dey worry us'
For Nigeria, piracy na still big issues to movie producers. Dis na sake of how plenti platforms don begin copy dia feems for free and e dey affect di business.
Ogbonge actress Omoni Oboli say digital piracy dey worri di feem industry.
"Wetin piracy dey do us, we no go sit quantify am. E get some platform wey no go take di feem becos dem don see say di feem don dey oda places for free through piracy."
She say plenti filmmakers dey lose money to piracy, and e no easy to fight sake of say di small small platforms wey dey pirate dia movies no get traces.
"Di money wey you suppose make back, e for plenti pass if dem no dey pirate di feem dem."
How filmmakers dey make money from movies
"Feem no be only one place na im money suppose come out from."
Na so Omoni Oboli wen we ask her how filmmakers for Nigeria dey make dia money despite di piracy saga wey dem dey face.
She add say money wey dem dey announce for cinema no be dat one go help di filmmakers make dia money back, say dem gatz still caryy am go some oda platforms wey dem go make profit.
"So if you say you no wan carry am go anoda platform, maybe you wan go back to your village."
Family and project
Dis ogbonge filmmaker say she no dey use her family play as dem be her support system for tins wey she dey do.
"Everitin else fit go but dat family na my true support and my backbone"
Omoni Oboli say she bring her ogbonge knowledge from big screen go streaming platforms wey make her feems dey clear and sharp.
On her next journey, she say wetin she get next go shock evribodi wen e come out.