BBC Pidgin of Thursday, 26 December 2024

Source: BBC

One-year-old artist, man wey hug tree and oda Ghanaians wey break Guinness World Records for 2024

Dis bi faces of some of di Ghanaians wey hold Guiness World Records Dis bi faces of some of di Ghanaians wey hold Guiness World Records

2024 na one big year wey Ghanaians no go fit forget.

Dis na sake of some of di big event wey happun inside di year.

Apart from di fact say di kontri bin hold one of dia peaceful election in history, Ghana also witness beta number of Guinness World Records for 2024.

In no particular order here na di list of Ghanaians wey break di world records through di tins wey dem sabi do.

Ace Liam

Ace-Liam Nana Sam Ankrah bin break di Guinness World Record for di youngest male artist wen e be one year and 152 days.

Ace Liam wit dis record, bin beat three-year-old Dante Lamb from America wey be di past record holder for 21 years.

Ace Liam dat time don do ova eighteen paintings since den and nine of di ten artworks im exhibit for di Soundout art exhibition for January don sell.

Abdul Hakim Awal

Abdul Hakim Awal bin set world record for di longest time to hug tree. Awal bin hug di tree for duration of 24 hours, 21 minutes, and 4 seconds. Na for 22 to 23 May 2024 for Kumasi di challenge bin take place.

Abdul bin tok say im reason for dat kain challenge na to raise awareness about di importance of afforestation.

Evans Aryee

Belgium-based Ghanaian strongman and powerlifter, Evans Aryee bin break di record for di fastest 400 kg incline frame carry over ten meters. On January 26, 2024, for Milan, Italy, e bin finish di challenge on di Lo Show Dei Record set in under 8.07 seconds.

Abubakar Tahiru

Abubakar Tahiru bin collect di title for di most number of trees hugged by an individual in one hour.

E bin hug 1,123 trees for Auburn, Alabama, USA, on 25 March 2024.

Abubakar Tahiru na forestry student for Auburn University,

Tahiru bin tok say e hope say im achievement go inspire young people for Ghana, wia e grow up, to care about nature and di environment.

Akosua Mantey Roselyn

Akosua Mantey Roselyn bin set di record for di longest marathon of applying makeup.

She bin run am for 103 hours, 25 minutes, and 33 seconds on 3 April 2024.

Akosua Mantey Roselyn aim na to raise awareness about teaching vocational skills.

Chelsea-Abigail Owusu Ansah

Chelsea-Abigail Owusu Ansah gbab her Guinness World Record for di most heads of hair locked by one pesin in eight hours on 6 March 2024. She bin lock 27 heads as hair-locking professional.

Jephthah Osarfo Appiah

Jephthah Osarfo Appiah bin achieve di longest video game marathon to play football (soccer) game by one pesin.

E bin play for 100 hours and 7 minutes from 1 to 6 of May 2024 for Victoria Island, Lagos, Nigeria.

André Ayew

Ayew na Ghana Black Stars captain, e bin achieve di record for di most appearances in di Africa Cup of Nations (Afcon) by one player.

Ayew bin make total of 36 appearances.

Felicity Asantewaa

Felicity Asantewaa break di record for di most cars washed in eight hours by one pesin, afta she clean 60 cars on 9 March 2024.