At least 24 pipo don die as plenti wildfires continue to dey hammer South Korea south-east region.
According to authorities, most of di victims dey in dia 60s and 70s and some 26 pipo don injure and 12 dey in critical condition as di deadly fires don make ova 23,000 pipo run comot dia house.
Acting President Han Duck-soo tok say "dis unprecedented" kasala dey "rewrite di record books for wetin be di worst wildfires for our nation history".
Di fires chop one 1,300 year old temple for Uiseong city wey bin get many cultural relics wey dem remove and take to safety.
Di first bin start for Sancheong county on Friday bifor e later spread enta Uiseong county.
Strong and dry winds carry di fire enta di neighbouring counties of Gyeongbuk, Uiseong, Andong, Cheongsong, Yeongyang and Sancheong.
On Tuesday, di national fire agency put di kasala at di highest fire response level.
On Wednesday, one firefighting helicopter crash for di mountains of Uiseong and e kill di pilot. Officials still dey investigate wetin cause di crash.
Thousands of firefighters and like 5,000 military personnel na im dem don deploy to contain di fires including helicopters wey di US military keep for Korea.
'E be like apocalypse'
Wildfires no too dey common like dat for South Korea. Dis current fires don alreadi be di one wey don kill di most pipo for history.
About 17,000 hectares (42,000 acres) of forests don also dey destroyed, wey go make dis fires di third largest for South Korea history based on area.
One resident wey dey stay one village for Andong tell BBC Korea say, "our house don burn down finish. E don completely collapse".
For anoda part of Andong, dem tell pipo wey bin dey shelter for one elementary school say make dem sharparly comot as di wind continue to spread di fire.
One 30-year-old man wey dey live for Uiseong tok say, "both di upstairs and next door houses bin dey burnt down. Dis area dey full of grandparents. Dem don dey here dia whole lives and wen dia houses burn down, dem no get anywia to go".
For di city of Uiseong, di fire scata di Gounsa temple wey be one of di largest temples wey di province build for 618 AD.
One 68-year-old monk say e bin dey "devastated" wen e hear of di destruction of di Gounsa temple. E tell AFP news agency say, "we go do our best to restore di function of di temple".
One Buddhist architectural structure wey dem call national treasure from di Joseon Dynasty (1392-1910) bin also dey destroyed, according to di forestry authorities.
For Andong, truck driver Lee Seung-joo say e see mountains dey burn as e bin dey drive. Di 39-year-old tell AFP say, "e be like di apocalypse".
Acting President Han say strong winds still dey make firefighting and rescue efforts to dey hard.
E say, "we dey desperately hope say rain go fall today or tomorrow to help quench di fire".
No rain bin dey forecast for di region on Wednesday and na only small like five to 10mm dey expected on Thursday, according to di Korea Meteorological Administration.
South Korea don dey experience drier dan normal times as dem dey get less rainfall dan average. Dem don already get 244 wildfires dis year, wey be 2.4 times more dan di same period last year.
Di goment don also promise to strengthen enforcement against illegal burning, wey be one of di main causes of wildfire. Dem go also crack down on individual carelessness.