Most of Hollywood dey full of thick smoke. You no fit see all di towering palm trees wey line streets for dia clearly.
Pipo and dia load scata for streets wey near di fire.
Pipo use sweatshirts to cover dia faces so dem go fit breathe. Many carry bags and suitcases looking for wia dem go fit go.
Some wear pyjamas, e clear say di whole tink take dem by Suprise. Pipo dey ask "Wia I go go?" "Wia dey safe?"
But no be only ordinary pipo dey run comot from dia house.
Hollywood celebs dey among pipo wey dey run for dia life as di California wildfire kontinu to spread and some of dem lose dia house.
Billy Crystal and Paris Hilton plus many oda celebs house burn down for di more dan 1,000 structures wey destroy as six separate wildfire blaze dey burn in and around di city, wey dey full of film stars mansions.
Tori be say house dem wey belong to Hollywood actors Leighton Meester and Adam Brody follow inside.
Jamie Lee Curtis, Mandy Moore, Maria Shriver follow for celebes wey along wit more dan 100,000 oda pipo, dey forced to leave dia house to escape out-of-control fires wey dey burn some of di most desirable areas for United States.
Some of di worst destruction occur for di beautiful enclave of Pacific Palisades, wia wind blow powerful fire explosion clear more dan 15,000 acres in size since Tuesday.
One part of di area, wey dey full of hillside streets on di Santa Monica Mountains and twist down to di beaches wey dey along di Pacific Ocean, dey reduced to ash.
Shriver, na journalist and former first lady of California wen she bin dey married to former Govnor Arnold Schwarzenegger, she say di destruction for di very expensive area dey devastating.
"Everytin don go. Our neighborhood, our restaurants," she write for X on Wednesday.
"Di firefighters don and still dey do dia best," Shriver add, "but dis fire dey big no be small and out of control."
The day after actor James Woods evacuated im house for Pacific Palisades, im say "every house around us bin dey on fire."
"We bin literally bin dey for di centre ghan of di fire as e start," Woods, wey dem sabi for di part wey im play for Nixon and Casino, Ghosts of Mississippi and Any Given Sunday, tok for CNN on Wednesday.
Woods cry for CNN as im describe losing in Pacific Palisades property.
"One day you dey swimming inside pool and di next day everytin don go," im tell di network.
Actor Billy Crystal for one statement say im and im wife, Janice, dey "heartbroken" by di loss of dia Pacific Palisades home wia dem don live since 1979.
Di "When Harry Met Sally" star add for di statement: "We raise our children and grandchildren here.
"Every inch of our house bin dey full wit love. Beautiful memories wey dem no fit take away.
"We dey heartbroken of course but wit love of our children and friends we go get through dis."
Tori be say, Jennifer Aniston, Bradley Cooper, Tom Hanks, Reese Witherspoon, Adam Sandler and Michael Keaton also get house for di Pacific Palisades.
Hotel heiress Paris Hilton say she lost her house for Malibu.
She write for Instagram post: "Sitting wit my family, watching di news, and seeing our house for Malibu burn to di ground on live TV na sometin weyn nobody suppose ever experience.
Miles Teller, wey dem abi pass for im role for Top Gun: Maverick, and im wife, Keleigh Sperry, also lost dis home, too, for Pacific Palisades.
Posting on Instagram, Sperry share one picture of di fires and broken heart emoji.
Oda stars wey dey forced to run leave dia house include Star Wars actor Mark Hamill and Schitt's Creek actor Eugene Levy.
For one post on Instagram, Hamill call di fire di "most horrific" since 1993, wen 18,000 acres burn, destroying 323 houses for Malibu.
Levy describe to local tori pipo Los Angeles Times say: "I bin no see any flame but di smoke bin dey very dark."
Actor Cameron Mathison also share video im house wey don reduce to flaming ruins. "We dey safe. But dis na wetin remain of our beautiful home," di General Hospital star write.
"Our home wia we raise our pikin dem and wia dem bin wan raise dia own one day."
Legendary songwriter Diane Warren, wey compose classic hits including If I Could Turn Back Time and I Don't Want to Miss a Thing, also lost her home.
She post one fotoof di beachfront near her house, saying di property we she bin own for almost 30 years don go.
Actor Steve Guttenberg, wey dem sabi for Police Academy, stay back to help firefighters by moving cars to clear way for incoming fire trucks.
Im beg fellow Pacific Palisades residents to leave di keys inside dia abandoned cars so dem go fit move dem.
Meanwhile, di Palisades Charter High School – wey dem use for di 1976 horror classic Carrie - don burn scata.
Former students of di school include director JJ Abrams, musician Will.i.am, and actor Forest Whitaker.
Hollywood sign dey at risk?
New fire break out on Wednesday night, di Sunset Fire, for di Hollywood Hills, near wia di world-famous Hollywood sign sidon gallantly on di hillside.
Though e dey really small compare to odas, di Sunset Fire bin burn just above Hollywood Boulevard and im Walk of Fame.
E go need to cross di 101 Freeway to touch di Hollywood sign and Griffith Observatory wey dey further up di hills.
Meanwhile, Los Angeles Fire Department bin issue evacuation order for pipo wey dey live for di area within Hollywood Boulevard for south, Mulholland Drive for north, di 101 Freeway or highway to di east and Laurel Canyon Boulevard to t di west.
Na within dat area Dolby Theater, wia dem dey do Oscars dey.
All star-studded events dey cancelled.
Next week Oscar nominations announcement already dey postponed by two days sake of di fire, organizers say.
Film premieres for Unstoppable, Better Man and Wolfman dey cancelled, so also di Screen Actors Guild Awards live ceremony.