You are here: HomeAfricaBBC2024 07 15Article 1940580

BBC Pidgin of Monday, 15 July 2024

Source: BBC

Police arrest suspected 'serial killer' afta dem see plenty deadi bodi for Kenya inside dump

Di dumpsite wey dem find di deadbodi dem Di dumpsite wey dem find di deadbodi dem

Kenya police don arrest one man wey dem call "serial killer" as e dey suspected say im kill nine women troway dia bodi for one rubbish dump.

Police tok say Jomaisi Khalisia 33 bin say im don allegedly kill 42 women since 2022, wey include im own wife.

Dem arrest di suspect as e bin dey bar dey watch di Euro 2024 final.

Pipo shock and vex all ova Kenya since dem find di bodi pieces dem on Friday for di capital of Nairobi.

Mohamed Amin wey be di oga of di Directorate of Criminal Investigations (DCI) say, "e confess say im lure, kill and troway 42 female bodies for di dumping site, we dem kill between 2022 to as recently as Thursday".

E tok say afta di arrest, di suspect carry di officers go iim house wey dey about 100m from di crime scene.

Oga Amin say dem bin find important evidence for di suspect house wey include 10 phones, one laptop, one machete, identity cards and women clothes.

Dem bin find di machete wey dem "believe say na im e use cut di victims", and nine bags like di ones wey dem use troway di bodi.

Since Friday, police don block di dumpsite wey dem find di deadbodies wey don decompose differently.

According to police, di victims bin dey between di ages of 18 and 30.

Police say dem still dey interrogate di suspect to find out why im kill pipo and e go show for court on Tuesday.

Kenya police watchdog bin tok bifor say dem dey investigate weda police get hand for di crimes sake of say di dumpsite dey close to di police station.

Di Independent Police Oversight Authority tok say, "widespread accusations of police involvement for unlawful arrests and kidnaps" mean say dem dey do dia own investigation to show weda di killings get any police connection.


  • 'I suppose to don die' - Trump tok as e vow to bring kontri togeda
  • Wetin we know about di 20-year-old FBI say carry out assassination attempt on Trump