BBC Pidgin of Tuesday, 10 December 2024

Source: BBC

Police fire teargas against femicide protesters for Nairobi

Kenyan police don fire tear gas to scata protesters Kenyan police don fire tear gas to scata protesters

Kenyan police don fire tear gas to scata protesters wey gada to march against rising cases of femicide in di kontri.

Dem don arrest three pipo, organisers say police reject dia request to hold di protest.

Di protesters mostly women carry placards dey march for Nairobi street, wia dem dey blow and shout, "Stop killing women!" but as police dey fire teargas na im di protesters dey regroup.

Amnesty International for Kenyan also confam say police arrest dia executive Irungu Houghton and three odas during di protest as dem demand for dia immediate relaese

"Dis brazen attack on di right to assembly na insult to justice. We demand dia immediate and unconditional release," @AmnestyKenya tok on dia X page.

Footage wey dey circulate online show say protest also hold for Mombasa and Lodwar.

Protesters allege say Kenya dey address gender-based violence silently and dem wan see di impact of dia advocacy.

'We ask for di permit and di county (authority) refuse, dem say di president don give us money and so dem no see any reason for us to protest," protest organizer Njeri Migwi tell di BBC.

In November, President William Ruto say im goment dey committed to tackle di rising cases, and promise 800,000 dollars towards one campaign wey dem call "Safe Home, Safe Space".

Di organisers don dey hold similar protests in di past, including one last January, whey dey peaceful and sanction by di authorities.

Di protestors dey call for end to di rising violence against women, as well as tougher laws to prosecute perpetrators.

Dem dey also criticise police approach were dey handle femicide cases.

Tuesday also mark di last day of di 16 days of activism protesting violence against women and children.

Police tok for one statement last month say dem don record 97 femicide cases in three months.

In September, Ugandan athlete and Olympian Rebecca Cheptegei die afta her boyfriend attack am ova land ownership. She die afta dem rush am to hospital wia 75% of her body don burn for di fire wey her boyfriend set.

In 2022, anoda athlete Damaris Mutua die for Kenya, authorities neva catch her killers but dem tok say her boyfriend confess to mutual friend say na im kill her.

Kenyan Police also arrest di husband of Agnes Tirop, afta im stab her for dia house.

Ibrahim Rotich, wey dey detention in di coastal city of Mombasa, go face charges once investigations dey completed, one official tok.

Twenty -five-year-old, Tirop die one month afta she break di 10km road race world record.

Authorities for Kenya still neva resolve di murder of Kate Mitchell, one British national wey dey work for BBC Media Action. She die for her hotel room for di capital Nairobi.