You are here: HomeAfricaBBC2024 08 28Article 1947975

BBC Pidgin of Wednesday, 28 August 2024

Source: BBC

Police release Telegram founder Pavel Durov, den transfer am go court

French police don release Telegram founder Pavel Durov French police don release Telegram founder Pavel Durov

French police don release Telegram founder Pavel Durov from custody on Wednesday and transfer am go court for questioning, days afta dem dramatically arrest am for one airport for Paris.

Di Russian-born billionaire leave di anti-fraud office outside Paris on Wednesday afternoon.

Goment lawyers say im go now face “initial questioning and possible indictment” for court for di French capital.

French authorities detain 39 years old Durov, for Paris Bourget Airport on Saturday on one warrant wey dey related to Telegram lack of moderation.

Dem dey investigate am on charges including allegations say im platform dey help fraudsters, drug traffickers and pipo wey dey spread child pornography.

Authorities bin place am in custody for up to 96 hours, di maximum amount of time wey pesin fit dey detained under French law before dem charge am.

Durov arrest don make pipo dey para about freedom of speech, plus cause some concerns for Ukraine and Russia wia e dey very popular.

Kremlin bin try calm fears for Russia about di future of di app, wit Russian goment tok tok pesin Dmitry Peskov attempt discourage users from deleting dia sensitive messages for di app.

French President Emmanuel Macron on Monday say di arrest of Durov “in no way dey political.”

Conversations on di app dey encrypted, meaning law enforcement agencies – and Telegram imsef – no too get access to wetin users dey post.

Di BBC learn say Telegram refuse to join international programmes wey aim at detecting and removing child abuse material online.

Di app no dey cooperate wit either di National Centre for Missing and Exploited Children (NCMEC) or di Internet Watch Foundation (IWF) - both dey work to find, report and remove such material.

According to officials di 39-year-old dey accuse of failure to cooperate wit law enforcement ova drug trafficking, child sexual content and fraud.

Di BBC don contact Telegram for comment about im refusal to join di child protection schemes.

Unlike all oda social networks, e no sign up for programmes like NCMEC CyberTipline wey get more dan 1,600 internet companies wey don register.

US based firms dey legally required to sign up but 16% of di companies wey dey participate na non-U.S. based.

Dem establish Telegram for Russia but e now dey based in Dubai, wia oga Durov dey live.

Di vast majority of child sexual abuse material reports come from tech giants and social networks including – Facebook, Google, Instagram, TikTok, Twitter (X), Snapchat and WhatsApp.

Di BBC understand say NCMEC don repeatedly ask Telegram make dem join to help tackle child sexual abuse material (CSAM) but e don ignore dia requests.

Telegram also refuse to work wit di Internet Watch Foundation, wey be UK equivalent of NCMEC.

IWF tok-tok pesin say “despite attempt to proactively engage wit Telegram ova di last year, dem no be members of di IWF and no fit take any of our services to block, prevent, and disrupt di sharing of child sexual abuse imagery."

As non-member of IWF or NCMEC, Telegram no dey proactively to find, remove or block confam CSAM wey dey categorised and added to lists di charities don comply.

IWF said that the company did remove CSAM once material was confirmed but said it was slower and less responsive to day to day requests.

Telegram also dey part of di TakeItDown programme wey dey worksto remove so-called revenge porn.

Snap, Facebook, Instagram, Threads, TikTok, Pornhub, OnlyFans all na members of di scheme wey dey use hash to list, scan for images and videos on dia public or unencrypted platforms.

Anoda norm wey Telegram no follow to na di usual way of Transparency Reporting.

Every six months social networks dey publish list of all di content wey dem dey take down becos of police requests.

Most oda social networks including Meta's apps, Snapchat and TikTok publish dia reports online wit previous years in library to refer to.

Telegram no get such website and only channel on di app wit no library history of transparency reports. E also describes im approach to Transparency Reports as "semiannual".

Di Telegram Transparency channel no reply to request to see previous reports and tok say " dem no get report available for your region".

Telegram also get unusual system for media in general. Di contact method na through automated bot on di app wey dis reporter neva get response for months of trying to get reaction to various requests.

E get unadvertised email address for press enquiries wey we don emailed but we neva response to.

In June Pavel Durov tell journalist Tucker Carlson say e only employ “about 30 engineers” to run im platform.

Dem born Durov, di founder of Telegram for Russia and now e dey live in Dubai. E dey hold dual citizenship of di United Arab Emirates and France.

Telegram particularly dey popular in Russia, Ukraine and former Soviet Union states as well as Iran.