Di new president of Ghana John Mahama don begin make new appointments into im administration afta im inauguration into office.
Dis new batch of nominations dey come afta di ones wey e appoint on Monday 6 January, 2025.
Na Tuesday 7 January 2025 dem swear President Mahama into office for di colourful ceremony wey happun for di Black Star Square for di kontri capital, Accra.
Dis new list na ministerial nominations for pipo wey go head different ministries under im administration and e say e don submit dia names go di parliament.
Meanwhile, rememba say a day bifor di inauguration ceremony for Accra, President Mahama bin appoint pipo into different positions as im administration set to take off- and some of di pipo e bin appoint so far na pipo wey don dey wit am bifor for im previous administration.
Dis na Mahama second time to be president of Ghana afta e bin serve as Ghana president bifor from 2012 to 2017- many expectations dey ontop am.
New ministerial list
On Thursday 9 January, 2025, president John Mahama don submit ministerial nominations to di Speaker of di Parliament.
According to di acting tok tok pesin to di president, Felix Kwaye Ofosu, di submission dey in accordance wit Article 78 of di 1992 Constitution of Ghana.
Di ministerial nominees na:
1. Hon. Dr. Cassiel Ato Baah Forson - Minister for Finance
President Mahama nominate five-term lawmaker and Finance expert, Hon. Dr. Cassiel Ato Baah Forson as Minister for Finance.
Dr Forson be ogbonge parliament member wey represent Ajumako Enyan Essiam constituency under di National Democratic Congress (NDC).
Profile of Hon. Dr. Cassiel Ato Baah Forson
Forson na Economist, Chartered Accountant, and Tax Practitioner wit extensive experience for public finance, macroeconomics, fiscal policy, tax policy, and business management.
According to di president tok tok pesin, Dr Forson get a PhD for Finance from di Kwame Nkrumah University of Science and Technology and Master of Science degrees for Taxation and Economics from di University of Oxford and the Kwame Nkrumah University of Science and Technology.
E get im Bachelor of Science for Accounting from London South Bank University.
Dr Forson dey well-known for di Ghana parliament and e go now serve as Minister for Finance once di parliament Speaker approve im nomination.
2. Hon. John Abdulai Jinapor - Minister for Energy
Hon. John Abdulai Jinapor also dey among di ministerial nomination wey go serve as Minister of Energy.
Di president say Hon Jinapor go bring im wealth of hands-on experience, competence, and know-how to di energy portfolio.
"Wit im extensive qualifications, particularly for energy economics and finance, e dey expected to bring much-needed dynamism and capabilities wey go transform di energy sector," ofosu tok for di statment.
Profile of Hon. John Abdulai Jinapor
Hon. Jinapor get a Master of Arts Degree (MA) for Economic Policy Management, MBA for Marketing and a Master of Science (Mc) for Development Finance from di University of Ghana.
E also get a Master of Science (MSc) Degree for Energy Economics from GIMPA and a Postgraduate Diploma for Finance and Financial Law from di University of London.
Hon Jinapor bin serve as high ranking member for di mines and energy committee representing Yapei-Kusawgu constituency for Ghana.
Once dem confam am, e go become Ghana Minister of Energy.
3. Hon. Dominic Akuritinga Ayine - Attorney -General and Minister for Justice
Hon. Dr Dominic Akuritinga Ayine wey be senior lawyer na di nominee for di position of Ghana Attorney -General and Minister for Justice.
Na member of NDC and e practice law well well for di kontri.
Profile of Hon. Dr Dominic Akuritinga Ayine
Dr Ayine na senior lawyer wey get three decades of experience for law practice.
Bifor, e serve as Deputy Attorney General and Minister for Justice and na di founding partner of Ayini & Partners Law Offices.
Dr Ayine get a Ph.D. for law from Stanford University, a Master of Laws (LLM) from di University of Michigan Law School.
Im Bachelor of Laws degree na from di University of Ghana as im don also lecture for di University of Ghana Law School for many years.
Once dem confam Dr Ayine, e go be Ghana Attorney -General and Minister for Justice under president Mahama.
President John Dramani Mahama names first batch of Ministerial Nominees. pic.twitter.com/hz0lyVyvM1
— Felix Kwakye Ofosu (@FelixKwakyeOfo1) January 9, 2025